Nine pipo don die afta car drive enta crowd for Vancouver festival Canada

Foto of emergency responders at di site of di Lapu Lapu day block party

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ambulance park for di site wey di incident happun
Read am in 4 mins

Vancouver police authorities for Canada don arrest one 30-year-old man wey drive im car into di crowd for Lapu Lapu street festival on Sunday morning.

Police don confam say nine pipo die afta di man drive through di crowd.

Dem neva tok di number of pipo wey injure during di tragic incident.

"As of now, we fit confam nine pipo don die afta one man drive through one crowd for last night Lapu Lapu Festival."

"Our thoughts dey wit all di pipo wey dey affected by dis tragic incident," di statement tok.

"Around 20:14 local time (04:14 BST), one man drive into large crowd during di Lapu Lapu Day Festival near East 43rd Avenue and Fraser Street", police tok for dia statement.

"Di driver dey for custody", di statement add.

Yoseb Vardeh, co-owner of the Bao Buns food truck, wey witness di scene tok say di incident happun during di Lapu Lapu Day festival.

Vardeh tell BBC World Service Weekend programme say di final live performance of di day, di main event, just finish wen one car drive through one narrow street wia food trucks dey, "completely straight, right through di crowd".

Yoseb tok say di vehicle dey move about 100km/h (62mph).

E tok say di driver stop, and try to run away, but pipo nearby catch am.

"I tink say e dey go for maximum damage," e tok, adding dat di driver kill some of im customers.

"I just see bodies under pipo food trucks, and husbands dey cry out for dia wife, or dia kids, e just dey horrible."

Foto of emergency responders at di site of di Lapu Lapu day block party

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ambulance park for di site wey di incident happun

Wia di incident happun

Acting police chief Steve Rai follow tori pipo tok as e wear m police uniform and tie, and tori pipo dey stand to di side wit recording equipment

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Vancouer acting police chief Steve Rai follow tori pipo tok

Acting police chief Steve Rai tok say di suspect na "lone male" wey dey im thirties.

"Di male subject wey we take into custody at di scene na di crowd catch am," and pipo in di crowd den immediately call di police, e tok.

"We den take am into custody," e add.

Rai tok say e no go speculate on how pipo in di crowd manage to catch di suspect, but im add say base on im own understanding "prior to police arrival", dem hold am bifor di officers arrive "shortly thereafta we take am into custody"

Filipino BC, di group wey host di local Lapu Lapu Day festival for Vancouver, share one map for dia website ahead of di festival to show attendees where di block party go take place.

Lapu Lapu Day na one of di biggest celebrations in di Philippines wey dey officially recognised by British Columbia two years ago.

Below na di map from di Lapu Lapu Day website, wey highlights section of road wia di festival go happun. Dis na wia police tok say di incident happun on E. 43rd Avenue and Fraser St.

Map show di location of di Lapu Lapu Day

Wia dis foto come from, Lapu Lapu Day

Canadian PM Mark Carney dey 'devastated' about di deadly incident

Mark Carney

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Mark Carney

Canadian Prime Minister Mark Carney, write on X say im dey "devastated" to learn about di events for Lapu Lapu festival in Vancouver.

"I offer my deepest condolences to di loved ones of pipo wey die and injure, to di Filipino Canadian community, and to everyone for Vancouver. We all dey mourn wit you," e tok.

"We dey monitor di situation closely, and thankful to our first responders for dia swift action."

'Na such beautiful celebration, such family event' - di

Also, Vancouver City Councillor Peter Fry don tell BBC say e feel "profound grief" over di incident dat "unprecedented in our city".

E don dey for di Lapu Lapu Day celebrations for some hours on Saturday, bifor di attack take place, and e describe am as “fantastic event".

"To see am turn so horrible so quickly and unexpectedly, I tink, di entire city dey in shock."

Fry say di event take place in more residential part of di city, wia fewer tourists dey go, and therefore di layout of di event dey even more "porous", dis fit be a factor in di incident.

E tok say e no believe say dem target Filipino community specifically.

Wetin be Lapu Lapu Day?


Statue of Lapu Lapu

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tourists stand in front of one statue of Lapu-Lapu

Lapu-Lapu na di the first indigenous Filipino to resist Spanish colonisation

Dem dey celebrate Lapu-Lapu Day every year in di Philippines on 27 April. e mark di memory of Lapu-Lapu, one national hero wey stand up against Spanish colonisation.

Di festival dey officially set up in Vancouver, Canada in 2023. One statement for dia website tok say, "di declaration no go only honour di heroic legacy of Datu Lapu-Lapu but also symbolise di cultural harmony and mutual respect dat thrive in di province of British Columbia."