Nigeria keep dia Fifa 2026 World Cup hope alive wit 1-0 win ova Rwanda

Read am in 7 mins

Super Eagles of Nigeria don try to keep dia Fifa 2026 World Cup hope alive wit 1-0 win ova dia group C counterpart Rwanda.

Afta di interesting 90miuntes of play and fantastic display of strengths from both Nigeria and Rwanda, point don divide dem for table.

Di Fifa World Cup qualifier game bin take place for Godswill Akpabio International stadium, Uyo on Saturday 6 September 2025.

Nigeria only goal come for di 51st minutes wen Tolu Arokodare score for di Super Eagles afta Ola Aina wipe di ball wey reach im side.

While some dey look am say e be like di goal na offside, no VAR dey to disturb di goal as di referee count am and Nigeria take di lead.

Struggling Nigeria bin first try dia chance for Rwanda goalpost wen Victor Osimhen and Ademola Lookman show dia skill and try put di ball for net. But dem disallow dat goal, e no count.

Sadly, Super Eagles striker Osimhen chop serious injury wey lead to how dem comot am for di game as e dey limp wit one leg.

Rwanda try to get equaliser from dia star man Innocent Nshuti but e no work as Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali dey catch evri shots on target.

Now, Nigeria go move up di group C table wit 10 points while Rwanda go remain for dia eight points.

Howeva, South Africa still dey lead di group wia Nigeria dey and any magic wey go hapun na for make one team lose, make anoda win.

Nigeria next game na against South Africa. Dat go be di only big chance to prove say di team dey ready to go di Fifa 2026 World Cup.

How di match take waka

Nigeria 0 - 0 Rwanda

FULL-TIME

90mins- Nigeria wit good defending against Rwanda. Tolu Arokodare miss dat opportunity. Counter attack for Rwanda, long shot on target but Nwabali catch am.

3 MINUTES ADDED TIME

89mins - Ball dey circulate well for di middle for Nigeria in search of goal

86mins- Nigeria gatz hold dis game down if dem wan win am, while Rwanda dey try find goal.

84mins- Stanley Nwabali save dat shot on target ooo, fantastic goalkeeper for Nigeria. Osimhen still dey ginger for di bench for di players to handle di ball well.

82mins- Ola Aina wit some good good positioning as experienced player. E step forward to take di throw-in for Nigeria.

Who dey carry ball run like dis? Na Nigeria player ooo, see speed, but Rwanda defender just block am witout stress. E suppose put more strengths.

80mins - Several chances for Rwanda but dem neva fit convert am to goal. Bizimana Djihad wit good control of di ball for middle

77mins - Innocent Nshuti don comot, e no too chine today afta Nigeria deny am chance to score goals for im team.

Good save by Rwanda goalkeeper again. Ntwari Fiacre push dat ball go corner for Nigeria.

75mins- SUBSTITUTION' Fisayo Dele-Bashiru don enta as Ademola Lookman comot for pitch. Di stadium dey hail am

WHAT A SAVE!!! Stanley Nwabali catch dat ball veri fast from di corner kick. Di Rwanda strike give a good header, but Nwabali say no way as e catch di all come lie down

72mins - CORNER KICK for Rwanda. Kavita Niyigena position to touch di ball.

70mins - Tolu Arokodare is offside, good pass but di referee catch am bifor e fit play

Same Nshuti again for Nigeria box 18, but Bassey clear di ball and e reach Nwobi side.

69mins- Rwanda wit di run, Nshuti wit di long good run. E shoot wide straight to di hand of Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali. Di keeper catch am direect

67mins- Nigeria dey find one more goal, while Rwanda dey find equaliser. Ndidi wit a good long pass to fi forward

Foul against Tolu Arokodare, e lie down for ground small but game don resume back

65mins- Rwanda goalkeeper to di rescue again!!! Dat ball for enta oooo, if no be say di goalkeeper push am. Tension don rise ooooo

63mins- Rwanda goalkeeper Ntwari Fiacre save dat great shot by Moses Simon. Veri good run by Moses Simon bifor e shoot straight into di Rwanda direction but di keeper save am.

Ademola Lookman try anoda shot but e no enta as di keeper save am too.

GREAT SAVE!!!

Ball don come back to play. Rwanda wit a good run heading to Nwabali

59mins- One Rwanda player don wunjure ooooo. E be like bloo dey comot from im nose afta e collide wit Nigeria player for front of di goalpost

57mins - Moses Simon wit di ball, good move, good push, incredible run wit di ball. E go shoot? Oh yes! Moses Simon shoot di ball but dem block am make e no reach di goalkeeper. Ball back in play

54mins- Ola Aina is down. What a tackle dia against di Super Eagles defender.

Tolu score im ogbonge goal for di Super Eagles just afta dem sub am make e enta for Onyeka

51mins - Tolu Arokodare score for Nigeria afta Ola Aina wipe di ball wey reach im side. No VAR to disturb di goal as di referee count am

GOOOOOOAAAAAAAAAAAAL

THROW-IN for Nigeria. Di Super Eagles dey play confam ball for front of di Rwanda goal.

SUBSTITUTION' Kwezera enta for Rwanda

49mins -Good chance for Ademola Lookman to score, but Rwanda defende block di ball from going near di goalkeeper

48mins- Ola Aina wit di ball, give good pass to Calvin Bassey wey dey control di ball for di middle looking for who to pass to

Rwanda also looking for chance to score goal so dem go fit get hope to qualify

Second half don start and di Nigeria team don dey charge to find goal

46mins - SUBSTITUTION' Onyeka don comot and Tolu Arokodare don enta for am

Nigeria no fit afford to lose dis match

SECOND HALF

First Half

Nigeria 0-0 Rwanda

Referee blow whistle for Half-time

45+5 Freekick for Nigeria dem play am but notin come, Nigeria still try to score but Rwanda defence no give Nigeria chance.

45+4 Freekick for Rwanda, dem play am but e no disturb Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali at all.

45+2 Fitina Mborenga of Rwanda don collect Yellow card.

45' Referee add 4 minutes

43' Match don stop against sake of anoda Rwanda player wey fall dey hold im leg, e dey receive medical attention.

40' Rwanda goalkeeper dey receive medical action, e be like say im sprain im shoulder wen im bin save ball wey Alex Iwobi fire beta shot.

39' Action neva too dey di ganme for di last two minutes di players Nigeria and Rwanda just dey run around for field.

36' Nigeria full Rwanda goal but di Rwanda defence no wan give di Super Eagles chance, dem dey block evri goal attempt.

32' Victor Osimhen don comot sake of injury Cyriel Dessers don replace am.

30' E be like say Victor Osimhen get in jury , e dey unstable since dem tackle am and im dey get medical attention now.

29' Nigeria don get three beta chances to score Rwanda but Rwanda defenders no dey let di Super Eagles balance to play di ball.

27' Throw-in for Nigeria, Ola Aina throw am but e land for Rwandan player head wey clear di ball fro counter attack attempt.

25' YELLOW CARD Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali afta e bin wan go fight sake of small kwanta wey happun between Nigeria and Rwanda players for field. Innocent Nsuti of Rwanda also collect Yellow card. Na di first yellow cards of di game be dis.

23' Rwand win freekick afta two Nigerian players tackle am. Dem play di freekick but e lead to goal kick.

20' Ademola Lookman of Nigeria head di ball for di goal area but e go wide.

17' Freekick for Rwanda, dem play am into di hands of Nigeria goalkeeper.

13' Rwanda collect ball from di resulting goalkick as dem try counter attack on Nigeria but notin come out.

12' Victor Osimhen of Nigeria dey beta position to score but Rwanda defender tackle am fall, e manage pass di ball team member wey fire di ball wide.

10' Nigeria make anoda goal attempt to score Rwanada but goalkeeper save am.

Nigeria 0-0 Rwanda

7' OFFSIDE! Victor Osimhen bin score but Linesman say na offside.

6' Ademola Lookman of Nigeria try to score nut dei ball go side of di goal post as Rwandan goalkeeper catch di ball.

5' Nigeria still dey hold ball di ball pass di Rwandans as dem dey try force di Rwandans out from dia goal post.

4' Victor Osimhen of Nigeria make attempt on goal but notin come out.

3' Nigeria dey try to hold possession of di ball.

1' Referee blow whistle match don start

Full provisional squad list

Nigeria

Goalkeepers: Stanley Nwabali, Amas Obasogie, Adeleye Adebayo, and Ebenezer Harcourt.

Defenders: William Ekong, Calvin Bassey, Ola Aina, Bright Osayi-Samuel, Bruno Onyemaechi, Igoh Ogbu, Chidozie Awaziem, Felix Agu, and Benjamin Fredericks.

Midfielders: Alex Iwobi, Frank Onyeka, Alhassan Yusuf, Wilfred Ndidi, Fisayo Dele-Bashiru, Raphael Onyedika, and Christantus Uche.

Forwards: Ademola Lookman, Samuel Chukwueze, Victor Osimhen, Moses Simon, Victor Boniface, Cyriel Dessers, Sadiq Umar, Nathan Tella, Tolu Arokodare, Terem Moffi, and Adams Akor.