Adamawa State Governorship election result 2023 update

Wia dis foto come from, Other
Di Independent National Electoral Commission don suspend di collation of result for di supplementary election wey happun for Adamawa state.
Dis na after di state Resident Electoral Commissioner of INEC Barrister Hudu Yunus Ari for one dramatic turn declare Senator Aisha Dahiru, alias Binani of di All Progressives Congress (APC) as winner of di Adamawa Govnorship election.
Inside one tweet on Twitter, INEC National commissioner for informate and Voter Education, Festus Okoye say di action of di REC de 'na usurpation of di power of di Returning Officer. E dey null, void and no get any effect.
Consequently, di collation of results of di supplementary election hereby don dey suspended.'' Di statement tok.
Before den, di Independent National Electoral Commission INEC say dem go continue with di collation and announcement of result for di Adamawa state supplementary election by 11 am on Sunday.
Dis follow di conduct of di election wey happun for 67 polling units on Saturday.
Di collation of di results from di local goment begin Saturday night wit di local goment returning officer announcing result from dia regions.
BBC reporter say some security personnel bin enta di collation centre, den di INEC official announce say collation go stop for di night to ''orders from Abuja''.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di collation bin dey go amidst heavy security presence for di state collation centre.
Di pipo of di state like many odas across di kontri dey wait anxiously for di result of di polls.
Di supplementary elections hold for 67 polling units wia dem bin scatter di 18 March gubernatorial polls.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) later declare say di election dey inconclusive.
According to di results wey INEC announce den, di incumbent govnor Ahmadu Fintiri of di PDP dey lead with 421,524, while Senator Aishatu Dahiru popularly known as Binani get 390, 275 votes.
If Aisha Dahiru win, she go become di first elected female govnor for Nigeria history.
Move around di map to see di results local goment by local goment [Dis na di results wey INEC declare inconclusive- dey refresh am for update]
Your device fit no support this visualisation
Na here you go see di complete results of di 28 states wen Inec declare dem
Your device fit no support this visualisation
















