BBNaija housemates: Kiddwaya, Lilo, Wathoni, Eric, Tolanibaj kiss during first Saturday night party in Big Brother Naija Season 5 lockdown

Read am in 2 mins

BBNaija housemates share first kiss during dia first Saturday night party in Big Brother Naija Season 5 lockdown.

Kiddwaya, Lilo, Wathoni, Eric and Tolanibaj na some of di house mates wey lips gum each oda own as dem dey gbedu di night party for di live television reality show.

Di first set of house mates to lock dia lips togeda, just 6 days into di 10 week TV reality show na Kiddwaya di son of billionaire Terry Waya and di Deputy Head of House Wathoni wey real name na Florence Wathoni Anyansi.

No be only Wathoni and Kiddwaya kiss, Tolanibaj also lock lips wit Kiddwaya too in dat same night.

Lilo and Eric kiss na im many fans see as di real deal on Saturday night sake of say di two don dey fall in love wit each oda inside di TV reality show.

Afta di party, di house mates still dey jolly and on Sunday night dem go know di first set of housmates wey fit chop eviction.