You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kanye West: Di America Rapper don tok sorry to im wife Kim Kardashian afta dem dry dia cloth for public
American rapper and producer Kanye West don tok sorry to im wife Kim Kardashian, five days afta e accuse her say she dey try lock am up sake of health mata.
West, wey announce say im wan run for US presidency, apologise to Kim say im no suppose carry dia private marriage mata come public.
Earlier last week West bin post one divorce message for Twitter, wey im later delete but now e don return to di social media platform to say sorry to im wife.
"I no cover her as she dey cover me. Kim I wan tell you say I know say I hurt you. Abeg forgive me. I thank you say you always dey there for me."
Kim na reality TV star wey don born four pikin with her husband wey she marry for 2014.
West claim say im wife dey try to lock am up on top health mata, because say im dey compare himself to Nelson Mandela.
All dis tins happun one day afta West launch im presidential campaign for Charleston, South Carolina, US.
Kim Kardashian later admit in public for di first time say na bipolar disorder wey Kanye get na im make am dey tok one tin today, tok anoda tomorrow.
End of Di one wey oda users dey read well well
She announce am for her Instagram stories on Wednesday afternoon wia she ask pipo to try understand say di mata don really affect her and dia family reputation.
Many of dia fans for social media dey react to di sorry post differently.