You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kanye West: America ogbonge rapper wan run for US 2020 presidential election - See who dey give am support
Ogbonge US rapper Kanye West, don enta Twitter to say im wan run for America presidential election 2020.
E neva clear weda oga West don fill any application form to run for president, or weda im even dey serious wit im tok.
US presidential election suppose happun in di next four months on November 3.
Pipo tok for social media
Kanye West don break internet wit im tok to be di next President of America.
Im post don provoke different kains of reactions for Twitter.
Some group feel say im plan to run for president no be bad idea at all, sotey ogbonge tech billionaire Elon Musk say im dey give im "full Support."
Oda pipo feel say e go be big mistake to vote an as president.
Odas still believe say oga West just dey do PR tok for im new album becos im don already late for dis election.
End of Di one wey oda users dey read well well