Anthony Joshua say 'racism na pandemic' for Black Lives Matter march

Wia dis foto come from, Reuters
Anthony Joshua don chook bodi for dis Black Lives Matter march.
'Racism na pandemic' - na wetin di British born Nigerian wey be world heavyweight champion hala wen im show face for protest on Saturday inside Black Lives Matter march for im home town for UK.
Di 30-year-old, wey dey wear knee protector as a "protection", read poem and speak in front of hundreds of pipo for im home town for Watford.
"Di virus don dey declared pandemic," Joshua tok.
"Dis don dey out of control. And I no dey talk about Covid-19. Di virus I dey talk about na racism."Racism na pandemic - Joshua
Di IBF, WBA and WBO world champion add say: "We stand united against aone virus wey dey instrumental for taking lives, taking lives of di young, old, rich, poor; virus wey dey unapologetic and spreads across all sectors."
At di march Joshua waka wit crutches and also use scooter after he feel "small pain" for im left knee during training dis week.
"Im doctor go later share check am but for now, nothing to worry about," im spokesman tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Di brace be precautionary measure on advice of physios."
Di protest be one of several across di kontri on Saturday following di death of American George Floyd.
Floyd, 46, die wen police dey arrest am on 25 May for Minneapolis. Di four officers wey dey involved don dey charged to court over di death, wey start days of protest for di US and Black Lives Matter demonstrations across di world.

Wia dis foto come from, Reuters
Joshua hope to fight twice for 2020 but in don accept say he no go fit do more dan one dis year sake of coronavirus pandemic.
Tok tok dey ongoing over wen and where im mandatory world title defence against Bulgaria's Kubrat Pulev go take place becos of di challenge of say dem no fit allow fans for di event.
Ideas dey float by Joshua promoter Eddie Hearn on di prospect of fight at Royal Albert Hall where only small number of expensive seats dey.
Pulev's team don raised di prospect of fighting outdoors for di Roman amphitheatre wey dey Croatia.
Those close to Joshua expect im injury no gp get impact on plans to fight Pulev and insist he wgoill be able to return to normal training for di short term.

Wia dis foto come from, Reuters













