Buhari visit to Lagos: 'My goment economic policies dey make impact' - Nigeria President to Business community

President Buhari in Lagos for his Presidential Campaign Rally

Wia dis foto come from, The Buhari Centre

Wetin we call dis foto, Buhari meet di Business community inside Lagos House, Marina
Read am in 1 mins

President Muhammadu Buhari on Saturday inside Lagos tok say im goment economic policies dey make di desired impact and di steady growth wey im say dey happun for inside Nigeria economy for di last three years, na evidence.

Wen im dey tok for one town hall meeting wit Business community inside Lagos, President Buhari say don im keep im promise to boost di economy, through blocking leakages inside goment purse, increasing spend money for projects and increase how dem dey make money, and im di make Economic Recovery and Growth Plan (ERGP), among odas.

Lagos Business community

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad

Wetin we call dis foto, Businessmen like Africa richest man Aliko Dangote and Billonaire Femi Otedola attend di meeting wit Buhari on Saturday

''I firmly believe say our economic policies don dey begin to make di desired impact. Economic growth don resume and e dey continue to improve."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Buhari meet di Business community inside Lagos House, Marina as part of im APC presidential rally on Saturday.