Precious Elekima: How Rivers SDP Governorship Candidate use thugs attack BBC Debate for Port Harcourt

Big gbege bin happen before BBC Govnorship Debate for Rivers State hold on Thursday 31 January, 2019.
Di Govnorship Candidate for Social Democratic Party SDP, Precious Elekima come with some jaguda boys come scatter di place.
Di candidate carry jaguda boys come venue of di bate as im say if im no take part for di debate e no go hold.
Tori be say Precious Elekima bin no dey among candidates wey suppose stand for di debate but im say na by force im must to follow stand with di oda candidates dem for di debate odawise e no go hold.
So early mormor na im e come wit di jaguda boys come block di gate of di place wia di debate suppose hold say if im no follow, di debate no go hold. Dem no gree any pesin enta di place come beat and rough handle di Editor of BBC News Pidgin, Adejuwon Soyinka.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 1
So in order for peace and security to tanda make di debate to hold, di Editor Soyinka come by force allow di SDP Candidate to follow stand with di oda candidates do di debate and di debate come start one hour late by 11am.
Di Editor, Adejuwon Soyinka come follow tori pipo yan afta evri evri say, "wetin happen dey very unfortunate and e dey below di standard of wetin pesin expect of pesin wey wan contest as govnor lead State as we expect say dat kain pesin go behave well, show oda pipo beta example. We dey very disappointed di way di SDP Candidate Precious Elekima behave."
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 2
Precious Elekima accuse di BBC say dem collect money before dem come do di debate naim make dem no put am for di debate.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di BBC Pidgin Editor Adejuwon Soyinka say if Elekima get any proof say im or any pesin for BBC collect money to do di debate form anywia, make im show dem because staff for BBC no dey behave like dat as dem dey work for international organization wey get high standard.













