Final goodbye for today
Na for here we go march brake for today live page update wia we don tell una some of di tins wey di candidates tok, post correct foto and show una kweshions and comments from social media.
Our next govnorship #BBCPidginDebate go shele for Delta State on 7 February.
We get confidence say una no go fall our hand and una go join us again on dat day. Till den, bye-bye.
We leave una wit dis audience member wey carri two hands up like pesin wey dey do 'tuale'!


















