Nigeria vs Cameroon: Wetin fans dey talk
As Nigeria dey play with Cameroon for Godswill Akpabio Stadium, Uyo, Nigeria, today, BBC News Pidgin go live for Facebook to talk with football fans about di match .
One Cameroon fan talk say dem go beat Nigeria like drum today.
Nigeria Super Eagles fan, Amadi Macaulay and im wife tell BBC Pidgin say dem believe say Nigeria go give Cameroon 2-0; and na Mikel and Moses go score.

Another Nigeria fan say di match go make sense, though Cameroon na better team but Nigeria go give them 2-1.
Then Mr Ignasius Nwankwo say e no too dey confident say Nigeria go show Cameroon pepper, because of how Cameroon don play Germany.

Di two team dey group B; Nigeria dey top di group with six points, followed by Cameroon wey dey two points; di bottom teams na Algeria and Zambia with one point each
Na only di team wey top di group go pick di ticket go di Russia 2018 World Cup.
Nigeria coach wey be Gernot Rohr don tell tori people say e no need to inform im boys how important wey this match dey.
End of Di one wey oda users dey read well well
As for Cameroon Coach Hugo Broos, all im own be say e need at least four point to make im team get chance to qualify.











