Public Holidays in Nigeria 2022: Bank holidays, Easter date, Labour day, Eid al-Fitr

Wia dis foto come from, Alamy
2022 work dey resume from Tuesday 4 January, afta di new year day and Christmas festivities wey mark di end of 2021.
Public Holidays in Nigeria dey up to 20 times for 2022, and for some Nigerians e already dey for dia minds to plan dia diary to joli di new year.
And yes, many dey look forward to di better things wey di year 2022 cari come including public holidays for di year.
Dis holiday mean say banks, businesses, schools and goment offices no go dey open dat day.
Dis na di likely public holidays wey di year 2022 cari for Nigeria:
Public Holidays in Nigeria 2022
- 1 January - Saturday - New Year Day
- 3 January - Monday- New Year Day Holiday (Dis na because New Year day fall for Saturday)
- 15 April - Friday - Good Friday
- 18 April - Monday - Easter Monday
- 1 May - Sunday - Labour Day
- 2 May - Monday - Labour Day Holiday (Dis na because labour day fall for Sunday)
- 3 May - Tuesday - Eid el Fitri
- 27 May - Friday - Children Day (Public Holiday for Schools and Children only)
- 12 June - Sunday - Democracy Day
- 13 June - Monday - Democracy Day Holiday (Dis na because Democracy Day fall on Sunday)
- 10 July - Sunday - Eid el Kabir
- 11 July - Monday - Eid el Kabir
- 12 July - Tuesday - Eid el Kabir Holiday (Dis na sake of say Eid el Kabir dey likely to fall on Sunday according to di Lunar calendar)
- 1 October - Saturday - National Day
- 3 October - Monday - National Day Holiday ( Dis na sake of say di National Day fall on Saturday)
- 8 October - Saturday - Eid el Maulud
- 10 October - Monday - Eid el Maulud Holiday (Dis na because Eid el Maulud fall on Saturday)
- 25 December - Sunday - Christmas Day
- 26 December - Monday - Boxing Day
- 27 December - Tuesday - Christmas Day Holiday (Dis na as e be say Christmas fall on Sunday)
How Nigerian authority dey declare public holidays

If any public holiday fall for week end, dem go declare di following week day as Public holiday.
Dis na according to how Nigeria Ministry of Interior dey announce public holidays over di years.
Na to compensate for di weekend wey pipo dey already dey accustomed to rest from work.
End of Di one wey oda users dey read well well














