2022 Countdown: Afcon, Nndamdi Kanu, Igboho, Ekiti election, Fifa World Cup, key events

2022 Countdown: Afcon, Nndamdi Kanu, Igboho, Osun election, 2022 Fifa World Cup, key events

Wia dis foto come from, Getty Images

Di year 2021 don pack im load waka and 2022 na di year wey many events don dey lined up already.

BBC Pidgin don highlight some of di events wey go happun dis year.

2021 African Cup of Nations

2022 Countdown: 2021 Afcon, Nigerian election, Fifa World Cup, 2022 key events to watch

Wia dis foto come from, Getty Images

Di 33rd African Cup of Nations [Afcon 2021] go start for Cameroon on January 9, 2022, and e go end on February 6, 2022.

Na Cameroon and Burkina Faso go open floor as both kontris go meet each oda on January 9.

Di reigning champion Algeria go meet Sierra Leon on di same day.

Football tournament like Afcon na strong uniting factor amongst Africans especially Nigerians.

Fifa World Cup

2022 Countdown: Afcon, Kanu, Igboho, Osun election, Fifa World Cup 2022 - key events

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, France team

Fifa World Cup dey expected to begin in Qatar for November 21, 2022 and end for December 18, 2022.

E go be di first world cup wey go happun for di Arab world.

Winter Olympics

2022 Countdown: Afcon, Kanu, Igboho, Osun election, Fifa World Cup 2022 - key events

Wia dis foto come from, AFP

Di 2022 Winter Olympics wey dey commonly known as Beijing 2022 go take place from February 4 to 20 for Beijing, People's Republic of China.

Dem be elect Beijing to host di Olympics at di 128th IOC Session for Kuala Lumpur, Malaysia in 2015.

Osun governorship election

2022 Countdown: 2021 Afcon, Nigerian election, Fifa World Cup, 2022 key events to watch
Wetin we call dis foto, Gboyega Oyetola and Rauf Aregbesola

Di governorship election for Osun State go take place on July 16, 2022.

Di current governor of di state na Gboyega Oyetola wey be member of di Nigeria ruling All Progressives Congress (APC).

Di governor dey eligible for re-election sake of say na only one term e still dey use.

Gboyega bin defeat Senator Ademola Adeleke wey run under Peoples Democratic Party (PDP) for di 2018 governorship election, according to INEC results.

Ekiti governorship election

2022 Countdown: Afcon, Nndamdi Kanu, Igboho, Ekiti election, Fifa World Cup, key events

Ekiti State Governorship Election go take place on June 18, 2022, according to Nigeria election office [INEC]

Independent National Electoral Commission on Tuesday 3 January, release di timetable and schedule of activities for di conduct of di election.

Di timetable from INEC headquarters in Abuja indicate say notice of election don already dey pasted for INEC office in Ado- Ekiti on January 3, 2022, showing say party primaries go start from January 4 and end on 29.

INEC Chairman, Prof Mahmood Yakubu, say di last day of withdrawal and replacement of candidates go be February 25, 2022 while campaigns go begin on March 20 and will be round off on June 16, 2022.

Nigeria general elections preparations

2022 Countdown: 2021 Afcon, Nigerian election, Fifa World Cup, 2022 key events to watch

Wia dis foto come from, Reuters

Politicians go begin prepare for di 2023 general elections dis year and many defections dey expected.

Politicians go begin defect from one party to di oda sake of say dem won win elections.

Many of dem go begin roll out dia campaign and begin make promises to voters.

General elections for Kenya

2022 Countdown: 2021 Afcon, Nigerian election, Fifa World Cup, 2022 key events to watch

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, President Uhuru Kenyatta gestures to im supporters

Di Kenya general elections go hold on August 9, 2022.

Kenyans go elect dia president, members of di National Assembly and Senate, county governors and members of di 47 county assemblies.

Na Uhuru Kenyatta be di current president of di kontri.

Former prime minister of Kenya Raila Odinga don declare say he go run for presidential election as he plan to succeed Kenyatta.

French presidential election

2022 Countdown: 2021 Afcon, Nigerian election, Fifa World Cup, 2022 key events to watch

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, France President Emmanuel Macron

Di presidential election for France go happun on April 10, 2022 and end on April 24, 2022.

Di current president of di kontri na Emmanuel Macron wey don dey power since May 14, 2017.

Sunday Igboho case

2022 Countdown: 2021 Afcon, Nigerian election, Fifa World Cup, 2022 key events to watch

Wia dis foto come from, Sunday Adeyemo Igboho Foundation/CFacebook

Sunday Adeyemo aka Sunday Igboho na Yoruba man wey dey clamour for Yoruba Nation and im dey currently detained for Benin Republic.

Sunday Igboho don dey detention since dem arrest am for July 19, 2021, for Cadjehoun Airport, Cotonou.

Before dem arrest Igboho for Cotonou, Department of State Security Services [DSS] for Nigeria bin don already declare am wanted as dem accuse am say he dey store ammunition.

Benin authorities bin accuse Igboho say im enter dia kontri illegally and also tok say di man plan to cause trouble. But Igboho deny di allegations.

Even though Igboho lawyer Pelumi Olajengbesi don step down as im legal representative, di case go still go on dis year.

And many pipo dey cross dia fingers as dem dey watch wetin go end am.

If dem go send Igboho back to Nigeria, or Benin authorities go still keep am, na only time go tell.

Nnamdi Kanu court case

2022 Countdown: Afcon, Nndamdi Kanu, Igboho, Osun election, 2022 Fifa World Cup, key events

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ipob leader Nnamdi Kanu court case adjourn until January 2022

Di leader of di proscribed group, di Indigenous People of Biafra [Ipob], Nnamdi Kanu, still dey di custody of di Department of State Services (DSS).

Kanu dey face charges on alleged terrorism and treasonable felony.

Di case go continue dis year and many pipo won know if court go find Kanu guilty or innocent. We gather dey expect wetin go happun.

Di trial of separatist leader of di Indigenous People of Biafra, Nnamdi Kanu don dey adjourned until 19th and 20th of January 2022.

Queen Elizabeth Platinum Jubilee

The Queen

Wia dis foto come from, Reuters

Dis year 2022 go make am 70 years wey Queen Elizabeth don become di queen of England.

Queen Elizabeth bin dey 25 years old wen she become queen for 1952.

Di queen go be di first British monarch to reach 70 years on di throne.

Di British monarch don celebrate her Gold, Silver and Diamond Jubilees before and dis one na Platinum Jubilee wey many pipo don dey expect.

Di Royal Mint bin release new designs of coin to mark di new year 2022 and di Platinum Jubilee.

Di designs take years to develop to mark memorable moments for history.