2021 End of Year: You want to bamba, Serve breakfast, Cut soap, Nigerian slangs in 2021

Wia dis foto come from, Facebook
Di year 2021 witness new Nigerian Pidgin slangs wey trend wella across di west African nation.
And yes no be year wey many pipo go forget in a hurry sake of say so many tings happun for Nigeria.
BBC Pidgin don highlight some of di popular ones.
E choke
E choke na one of di popular slangs for Nigeria.
Many pipo dey use am express themselves wen dem dey shocked or surprised.
Some dey use am mock dia enemies wen something good happun to dem.
Na Nigerian artiste Davido bring di slang.

Wia dis foto come from, Davido
You want to bamba
Dis slang come from inside Goya Menor and Nektunez amapiano remix of Ameno.
End of Di one wey oda users dey read well well
E mean say pesin won join big boys and roll with dem.
If one pesin say another person wan bamba, e mean say di person wan join league of pipo wey pass am.
Doings
Doings na slang wey pipo dey use describe say level pass level wen dey do something wey cost a lot of money.
Singers Flavour and Phyno na two pipo wey many credit as originators of di slang.
Pesin fit spray couple hard currency for wedding and describe am as doings.
Anoda pesin fit buy im three children Lamborghini on di same day and describe as doings.
Chop breakfast or serve breakfast
Wen pesion say anoda pesinn don chop breakfast or dem don serve am breakfast, e mean say dem don break di person heart.
Serve breakfast follow di many reports and tori of marraige breakup wey happun during di year.
'Cut soap for me'
Na internet fraudsters aka Yahoo boys wey wan dey successful like dia colleagues bring dis slangs.
Dem believe say dia successful colleagues don visit herbalists wey don give dem soap to baff so dia victims go fit pay.
So when one broke Yahoo boy see colleague wey get money, e go begin tell am to cut soap for am.
However, no be only Yahoo boys dey use dis slang, pipo wey dey do legitimate work sef dey use am.
Pesin fit ask im friend wey dey successful to cut soap for am, meaning say make dat friend show am di way or give am business opportunities.
Who dey breet?
Who dey breet no get particular meaning - E get many usage and context.
Pesin fit use di slang to show off or to make haters humble.
You fit also use di slang to call pipo attention to beautiful moment wey dey go on.
Pesin fit buy one expensive car and make video of di car and begin shout "who dey breet?"
Aza
Dis slang mean bank account number.
If person say make you send your aza, e mean say make you send your account number.
Wahala be like bicycle
Dis na one of di popular slangs for 2021, and pipo dey use am after unpleasant situation happun.
Two pipo fit dey fight and pipo wey dey observe or settle di fight fit just say "wahala be like bicycle".
'You get it... If u don't gerrit forget abou-rrit'
Dis phrase become slang after one Nigerian man wey dem ask di full meaning of CV use am.
One lady bin ask di man, Segun Old Skool Sege, di meaning of CV inside one viral skit.
And im tell am say e mean certificate, then di man whistle and tell di lady say;
"You gerrit... if you don't get it, forget about it".
Many pipo dey use di slang to tell odas say dem no fit do explanation pass wetin dem sabi and if dem no still understand, make dem no bother themselves.
Sapa
Sapa na slang wey mean say person broke.
Di slang also mean spirit of poverty wey dey follow person wey never become successful for im life.
Wen pipo say sapa dey beat dem, e mean say dem dey broke.
Village pipo
Di slang village pipo don dey trend before 2021 and e still trend for dis year.
Village pipo refer to enemies of progress wey dey village.
Wen pipo make mistake, odas fit say na im village pipo dey behind am.
'No be juju be dat?'
Dis slang na still phrase from Asari Dokubo and pipo dey use am express shock or surprise.
Wen person do something wey dey surprising or shocking, pipo fit just ask say "no be juju be that?"
'70 years old man o'
Di phrase "70 years old man" become popular slang after Asari Dokubo use am refer to Charly Boy.
Dokubo wey be former militant leader for Niger Delta bin do video speaking on national issues wia e tok say;
"Wen di issue of Biafra come, Charly Boy tok say im no dey in support of Biafra. We are rascal we are this ting, 70 years old man o."
Many Nigerian skit makers dey use dis slang for dia skits.
'Our mumu no too much'
Na Charly Boy bring dis slang but na Asari Dokubo make am trend for 2021 wen he reply Charly Boy, alleging say 'na im mumu nai too much.
"Di same Charly Boy say our mumu don too much. Charly Boy, na your mumu nai too much." Na so Asari Dokubo tok for di video wen im dey address national issues .
Ever since many skit makers dey use am for shot video for 2021.

'Na wetin... I wan dey do now'
Dis phrase na one of di popular slangs for di year 2021 and e get many meanings.
Pipo fit say na wetin fit land dem for jail dem wan dey do now.
Another pesin fit say na wetin no concern am e won dey shook mouth now.
Odas fit tok say na wetin fit scatter pipo relationship dem won dey do now.
Di list dey endless.
Japa
Dis slang na one of di popular slangs for Nigeria as many youths dey leave di kontri for abroad.
Di slang simply mean say make person run out of unpleasant situation.
Many pipo wey wan leave Nigeria for abroad dey tok say dem wan japa.
Shedi bala bala
Dis slang na hook from one song by DJ Basplit and Hypeman Bobby Banks but na hypeman Jerry Shaffer originate am.
Dis hook dey tell women make dem shake dia backside.
If DJ never play dis hook for clubs and night parties, den di DJ never complete im work for dat night sake of say many party rockers dey always wait for am.
Ko Po Ke or KPK
Wen pipo say Ko Po Ke or KPK, e mean say "e no plenty?"
Pesin wey buy car or build house fit upload am on social media and caption am with KPK. E mean say who wan tok say dis achievement no plenty?
Di response to Ko Po Ke na O po Pa (OPP) or O Po Gan (OPG).
Ment
Ment na slang to describe say pesin fit get mental challenge.
If you say pesin dey ment, e mean say di pesin no dey reason normal or mentally correct.
Sorosoke
Pipo dey use dis slang to tell odas say make dem speak up so dat dem go fit hear dem.
Nigerians use dis slang well during di EndSARS protest of 2020 to tell odas say make dem speak up against police brutality.
Nollywood actress Toyin Afolayan popularly known as Lola Idije na she bring dis slang.
Mafo
Mafo na slang wey singer Naira Marley bring and e mean say make person no dey bothered or worried.
If pesin tell im friend say mafo, e mean say make dat person no bother imself.
Werey dey disguise
If pesin say werey dey disguise, e mean say di pesin wey e dey refer to dey pretend or hide im true colour.
We meuve
Big Brother Naija former housemate Vee na she bring dis slang.
She bin dey quarrel with her lover Neo for inside one room for Big Brother Naija and she tell am say make he move from di door so dat she go fit go outside.
Sake of Vee foreign accent, di "move" sound like "meuve" and since den Nigerians don dey use di slang.
Pipo dey use di slang as a motivational phrase wen tings no dey go as expected.
Person wey just chop breakfast fit say e no fit kill imself sake of say life goes on and we meuve.
Pidgin language background
Pidgin na one of di most widely spoken languages inside West Africa.
Researches don show say up to 75 million speakers of Pidgin dey inside Nigeria - dey speak Naija Pidgin.
But Pidgin no get a standard written form. However e dey so expressive and e dey bring pipo togeda.
Pidgin alsa reaffirm one shared African identity.
Dr. Christine I. Ofulue, wey be professor of linguistics for di National Open University of Nigeria, wey specialize in Pidgin, say;
Di language dey reflect Africa relationship with outsiders over di centuries and na evolving from di language of di slave trade to a form of resistance and anticolonialism.
You fit also dey interested to watch:
Wetin be Pidgin?
Na mix of English and local languages wey dey enable pipo wey no dey share a common language to communicate.
West African Pidgin English bin serve as a language of commerce dem bin dey speak along di waterside area during di Atlantic slave trade inside di late 17th and 18th Centuries.
Pidgin dey widely used in Nigeria, Ghana, Cameroon, and Equatorial Guinea
Primarily na oral language, without a standard agreed written form.
For Sierra Leone, Creole or Krio (wey almost belike Pidgin) na di official language wey dem dey speak throughout di West African nation.
















