2021 Year end: Stan Nze, Yusuf Buhari, Toyin Lawani, Woli Arole, celebs wedding in 2021

Wia dis foto come from, Other
2021 come wit colourful memories for those wey say "I-Do" wit dia partner despite di coronavirus pandemic.
Dis year 2021 witness many many "I-do" and some of dis weddings become top for discussion as par who di couples be for Nigerian society.
Marriage na important aspect of life for many pipo and for two pipo to become man and wife dem gatz do wedding.
From Ikejiofor Ella Amy wey she and her husband wear "Isi Agu" do church wedding, to ogbonge Nigeria celebs like Nigeria musician Harrysong tie knot.
Nigeria President first son, Yusuf Buhari and Princess Zahra Bayero, all of dem make news as high profile weddings for di west African nation in 2021.
Nigerian actress, Inidima Okojie, Toyin Lawani, Nollywood stars Stan Nze and Blessing Jessica Obasi, all dey among a list of top profile couple wey wed dfor di outgoing year.

Wia dis foto come from, MM
Muhammadu Buhari wed Zahra Nasir Bayero
Yusuf Muhammadu Buhari and Zahra Nasir Bayero finally marry for Bichi Kano State on 20 August 2021.
Yusuf and Zahra tie di knot for pride prize of N500,000 [about $1,000].
End of Di one wey oda users dey read well well
Na Communications Minister Isa Ali Pantami join di couple.

Wia dis foto come from, @Ikejiofor Ella Amy
Ikejiofor Ella Amy "Isi Agu wedding
Ikejiofor Ella Amy and her husband trend for social media afta fotos of di "Isi Agu wedding dress go viral.
Di common tin na to wear white wedding dress and suit for church wedding for Nigeria, but Ella an her husband decide to explore mixture of traditional and English style.
Di bride tell BBC Pidgin say her decision na out of di love wey she get for Africa and black pipo and to also create sometin wey dey different.

Wia dis foto come from, Instagram/Inidimaokojie
Ini-Dima Okojie wedding
Nigerian actress, Ini-Dima Okojie tie di knot traditionally wit her bobo, Abasi Ene-Obong.
Di 'Namaste Wahala' actress share fotos for her Instagram page say:
"Abasi, my love!!. Today, our families accept to become one.
I dey so excited to go on dis journey with you… dis' na to forever!."

Wia dis foto come from, Harrysong/Instagram
Harrysong wedding
Ogbonge Nigeria musician Harrysong tie knot wit im sweetheart Alexer Peres for Warri for March.
On February 4 musician shock social media as im announce im engagement.
"I get am perfect dis time" Harrysong post on im Instagram page say e don go off di market.

Wia dis foto come from, other
Ruth Abioye - Bishop David Abioye dauter wedding
Ruth Oluwatoyosi Abioye, di only daughter of Bishop David Abioye, di First Vice President Living Faith Church Worldwide wed her heartthrob Inalegwu Abraham Ogbole.
Di traditional wedding bin hold on Friday 29th October while di church wedding hold on Saturday 30th October 2021.

Wia dis foto come from, @olayinka_peter/Instagram
Peter Olayinka wed Yetunde Barnabas
Super Eagles footballer Peter Olayinka take di bold step wit im sweetheart Yetunde Barnabas for May 2021.
Di two tie di knot afta dating for two years.
Di wedding bin be roll call of football stars like Victor Osimhen, Simon Moses, Paul Onuachu and Henry Onyekuru.

Wia dis foto come from, Stan nze
Stan Nze and Blessing Jessica Obasi wedding
Two popular Nollywood stars Stan Nze and Blessing Jessica Obasi wedding go down on Saturday September 11, for Lagos.
Di couple don dey date for a long while before dem marry.
Di two already do dia marriage introduction a week before di wedding for Stan Nze wife hometown inside Abia State, south eastern Nigeria.

Wia dis foto come from, Emiralty Africa
Lateef Adedimeji wed Adebimpe Oyebade
Nigerian Actor Lateef Adedimeji wed im colleague for di movie industry actress Adebimpe Oyebade.
Di wedding wey happun for Ikole Ekiti, Ekiti state witness plenti pipo plus popular actors and actresses for di movie industry.
Di popular actor wed beautiful Bimpe on December 18.

Wia dis foto come from, @tobibakare
Tobi Bakare wedding
Reality TV star Tobi Bakare match im baby Anu Oladosu go seal di deal on 21 August, 2021.
Di star enta im Instagram to share di lovely fotos of im traditional wedding ceremony.

Wia dis foto come from, tiannahsplacempire/Instagram
Toyin Lawani wedding
Fashion celeb Toyin Lawani na di number ten pesin for out list f ten couples wey make dis for dia wedding for 2021.
She marry her husband Segun Wealthy wit black wedding dress for ceremony wey dem do for 12 June 2021.

Wia dis foto come from, @officialarole/Instagram
Woli Arole wedding
Comedian and actor Toyin Bayegun alias Woli Arole follow say "i do" inside dis 2021.
Woli Arole marry im bae Yemi.

Wia dis foto come from, @debolalagos/Instagram
Debola Lagos wedding
Co-founder and di CEO of RED for Africa Adebola Williams aka Debola Lagos marry im sweetie for very colourful wedding for Lagos.
Adebola marry Kehinde Daniel, di daughter of former Ogun state govnor.
Di high and mighty na im full di wedding wey happun for August 2021.
















