BBNaija S6 eviction today: Saskay, Yousef dey evicted from Big Brother Naija Shine Ya Eye

Wia dis foto come from, BBNaija
Saskay and Yousef chop eviction on Sunday night from Big Brother Naija "Shine Ya Eye" TV reality show.
Saskay and Yousef fall out as di first two housemates to be evicted for di night.

Wia dis foto come from, BBNAIJA
Angel, Cross and Emmanuel also dey nominated for possible eviction from Big Brother Naija season six for di night.
At least one or two if not three of these five housemates fit comot from di "Shine Ya Eye" edition on Sunday 19 September, 2021.

Wia dis foto come from, BBNaija
Housemates wey survive Ebuka Uchendu live eviction show on Sunday night go still get chance to win di 90 million naira [about $218,596USD] star prize.
As 29-year-old Yousef step out of di house, e tell Ebuka for di live show say im dey eye to do movies afta spending eight weeks for di TV reality.
Saskay on her part reveal to Ebuka say she don already taya for di TV reality show.
Di 22-year-old say setting up a retirement home for old pipo and her lip-gloss brand na im dey her mind after di show.
End of Di one wey oda users dey read well well
Shortly after di live eviction show, Angel hala on her own say she surprise say pipo vote for her to remain.
Angel hail her papa say if na so, him wey be PR pesin dey do a great job.
Di BBNaija na Nigeria biggest TV reality show and most housemates wey contest dey turn celebs for di kontri.

Wia dis foto come from, BBNaija
How BBNaija Housemates nominate for eviction dis week
- Whitemoney - Angel and Yousef
- Saskay - Yousef and Emmanuel
- Saga - Yousef and Angel
- Angel - Saga and Emmanuel
- Yousef - Liquorose and Cross
- Liquorose - Angel and Yousef
- Pere - Nini and Angel
- Nini- Emmanuel and Angel
- Cross- Nini and Whitemoney
- Queen - Yousef and Saskay
- Emmanuel - Saskay and Pere
Angel, Cross and Emmanuel survive Sunday eviction las las.













