Prophet TB Joshua: Evelyn Joshua Synagogue dey EFCC investigation for alleged fraud

Wia dis foto come from, Screenshot
EFCC dey investigate TB Joshua church for huge financial misappropriation.
Nigeria anti-corruption police EFCC don confirm to BBC Pidgin say dem dey investigate Synagogue Church of All Nations [SCOAN].
Economic and Financial Commission say na case of alleged fraud by some leaders for late prophet TB Joshua church.
Dia tok tok pesin Wilson Uwajeren say dem receive petition from di church but e no clarify di ka in case e be and who dey involved.
EFCC na Nigeria goment team wey dey in charge of fraud and oda moni related crime.
For secret documents wey BBC Pidgin sight, EFCC invite over 15 members of di church.
Synagogue Church of All Nations [SCOAN] na one of Nigeria biggest church wit thousands of followers home and abroad.

Wia dis foto come from, Screenshot
Dem gatz come ansa kwesion ontop fraud case wey dem say dem dey investigate for di church.
End of Di one wey oda users dey read well well
Local tori pipo Guardian report say some leaders allegedly cease power for di church once di prophet die.
Di report say dis set of leaders allegedly enta di church vault pack money wit bags.
E allege say dem also put up prophet T. B Joshua private jet for sale plus oda allegations.
For one press statement, Barrister James Akhigbe wey say im be lawyer to SCOAN tok say;
Dem discover huge financial misappropriation for di church since di prophet die and dem dey handle di matter.
Tori be say since di founder of SCOAN TB Joshua die plenti tori bin don dey fly upadan say di church dey get leadership tussle.
However di tori later balance on Monday wen di church announce say di prophet wife Evelyn Joshua go now be di new leader of di church.
E never still clear how much dey involved in di fraud case, but di church say dem dey do audit.
Prophet TB Joshua die for di month of June under unclear circumstances. Dem bury am a month later for July.

Wia dis foto come from, TB JOSHUA
SCOAN appoint TB Joshua wife, Evelyn as new leader
Tori of her emergence as leader start last week wen some members of di church allegedly carri her matter go court.
Those ones say make court declare her member of di board of trustee of di church.
Di court grant di request and add her name to di three man board of trustee.
Before di church trustee matter pop up, di church bin dey role wit no known leader or G.O. since di prophet die.
For one press conference before di burial of di late prophet, SCOAN representatives tell tori pipo say issue of who go lead di church na spiritual matter.
Wen Prophet TB Joshua die
Prophet TB Joshua die on June 5, 2021 ontop unclear circumstances.
And dem bury am for di church compound a month after for July.
Tori of him death shock plenti pipo as pipo dey see am as miracle worker.
Dis na unto sat plenti show miracles wey dem dey broadcast for dia dedicated Synagogue church church TV station - Emmanuel TV.
TB Joshua dey reputed as one of di ogbonge tele-evangelists wey get large followership for inside Nigeria and abroad.














