JAMB cut-off mark for 2021: Universities and Polytechnics wey don set cut off mark for 2021/2022 admission

Bayero University Kano

Wia dis foto come from, BUK

Some Nigerian Universities don begin set cut-off marks for 2021/2022 admission.

So candidates wey choose dis universities as choice of study for 2021 Unified Tertiary Matriculation Examination registration fit know weda dem qualify.

Dis development dey come as di Joint Admission Matriculation Board cancel general cut-off marks for admission into tertiary institutions.

Jamb give schools freedom to set dia own minimum mark for admission.

Di board take di decision for di 2021 policy meeting wey di Minister of Education, Adamu Adamu chair.

JAMB registrar, Prof. Ishaq Oloyede wey list some universities wey don release dia own cut-off mark say:

"Institutions now get liberty to decide cut off marks, JAMB no go give cut-off marks again."

Universities wey don release cut-off marks

University of Maiduguri - 150

Usman Dan Fodio University - 140

University of Sokoto - 140

Pan Atlantic University - 210

University of Lagos - 200

Lagos State University - 190

Covenant University - 190

University of Ilorin - 180

Osun State University - 160 but candidates wey dey find admission int programmes like Nursing, Medicine, Law Common and Islamic Law must score 200.

Kogi State University - Di cut-off mark dey between 160 - 220 depending on di course of study.

Ahmadu Bello University - 180

Rivers State University - 160

Benue State University - Di university authority say academic board never decide wetin go be di cut-off mark for 2021/2022 admission.

Nnamdi Azikwe University - Admission officers go meet to decide di cut-off mark soon.

Bayero University, Kano - 180

However for BUK di cut-off marks for some programmes vary as follows:

  • Faculty of Allied Health Sciences - 200
  • Faculty of Clinical Sciences (MBBS) - 250
  • Faculty of Dentistry - 200
  • Faculty of Pharmaceutical Sciences - 220
  • Faculty of Law - 220
  • Di cut-off mark for Blind candidates (Only) wey apply for admission to di University go be 160.

Ignatius Ajuru University of Education - 140. Candidates wey choose di institution as first or second choice or no even choose am at but wish to get admission for there must score 140 and above.

Federal College of Dental Technology and Therapy, Enugu - 120

Polytechnics wey don release cut-off marks

Federal Polytechnic, Nasarawa - 110. Candidates go dey required to sit and obtained 110 score for di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).

Delta State Polytechnic - 140. Candidates wey choose Delta Polytechnic as first or second choice or no even choose am at all but dey consider di institution for admission must score 140 and above.

We still dey update dis tori as more universities set cut-off mark for 2021/2022 admission, make you, refresh later to check any more updates.