You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Haiti president dead: Jovenel Moise killed for im house by gunmen
Dem don assassinate di serving president of Haiti for im home for early Wednesday morning, di government don confirm.
Haitian Prime Minister Claude Joseph tok inside statement say di assailants kill Jovenel Moise for e Port-au-Prince residence around 1 a.m local time (05:00 GMT).
Tori be say di First Lady also wunjure for di attack.
Oga Joseph say "dem don take all measures to guarantee to continuance of di state".
Im don take control of di poor Caribbean nation, and e don urge di public to remain calm.
Im call di shooting of di president "heinous, inhuman and barbaric act".
Jovenel Moïse, 53, don dey in power since February 2017, after e predecessor in office, Michel Martelly step down.
Oga Moïse time for office bin no dey smooth as im face accusations of corruption and bin dey challenged by waves of violent anti-government protests.
End of Di one wey oda users dey read well well
Protests bin hold for di capital and other cities earlier dis year, as pipo bin demand for im resignation.
Haiti opposition tok say Oga Moïse five-year term suppose don end on 7 February 2021, five years to di day since Mr Martelly step down.
Mr Moïse, however, insist say im bin get one more year to serve as im no enter office until 7 February 2017.
Allegations of electoral fraud cause di year-long delay and e eventually lead to di cancellation of di result of di 2015 election. Dem later hold fresh elections, wey Moïse later win.