You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nnamdi Kanu arrest, Sunday Igboho house raid make Muhammadu Buhari praise 'professional way' of security agencies
Nigeria president Muhammadu Buhari don hail di professional way security agencies handle di arrest of Nnamdi Kanu and raid of yoruba activist, Sunday Adeyemo house on Thursday.
For inside statement, President Buhari say di acts of di security agents "must be commended" and dem suppose "sustain dis level of professionalism".
Dis comments by di President dey come days afta Nigeria Minister of Justice, Abubakar Malami announce di arrest of Kanu wey be di leader of di ban Indigenous People of Biafra.
Days afta Kanu arrest, Nigeria secret police - Department of State Services - carry out raid for di home of Yoruba activist, Sunday Adeyemo alias Sunday Igboho. Dem allege say im get weapons and since don declare am wanted. Im lawyer don since deny di accuse and demand 500 million naira compensation.
President Buhari through im Media aide, Garba Shehu wey release di statement claim say Igboho na "militant ethnic Secessionist, wey also bin dey conduct acts of terror and disturbing di peace under di guise of protecting fellow 'kinsmen'."
'Goment bin don dey monitor Nnamdi Kanu and Ipob'
Since di arrest and court appearance of Kanu for court, di goment bin don dey tight-lipped over how dem gbab di Ipob leader.
Di president say dem detain Kanu "as a result of cross-border cooperation. Rumours don dey say na for Nairobi dem arrest am, but di Kenyan High Commission to Nigeria don since distance demsef from "such claims".
President Buhari allege say Kanu secessionist group, Ipob, don carry out violent attacks for di Nigeria south-east and na "since goment don dey monitor di activities of Ipob and bin get strong cause to believe say their funding sources include proceeds of suspected illicit criminal activities."
End of Di one wey oda users dey read well well
'Assault weapons no be tools of peace'
According to di DSS tok-tok pesin Peter Afunanya, wen dem raid di activist house based on intelligence report say im dey gada weapons to cause kasala within di region, dem allegedly recover AK-47 weapons, charm, dollars and im international passport.
Garba Shehu statement read say di order by President Buhari for security operatives to shoot anyone wey carry AK-47 weapon dey clear thereby im justify di actions of di DSS.
Im say: "Assault weapons no be tools of peace loving pipo and as such, regardless of who dem be and where dem from, Security Agencies go treat dem all di same.
Di presidency also add say di goment respect fundamental human rights of citizens to express dia views like Igboho dey do.
But im say e don dey conduct "acts of terror and e dey disturb di peace" and goment go stop any attempt by anybody to undermine Nigeria unity.