Coronavirus new variant: France, Germany, Ireland, Netherlands ban flights from UK, see odas wey dey consider am

Empty Eurostar departure hall FOR St Pancras, London, on 25 November 2020

Wia dis foto come from, Getty Images

Some European kontries don begin apply travel bans with di UK afta e tok say one new more infectious coronavirus variant dey "out of control"for dia.

Ireland, Germany, France, Italy, the Netherlands and Belgium, all dey suspend flights and travel, although di measures different.

Dem go do one EU meeting on Monday morning to discuss response wey go dey more co-ordinated.

Di new form of coronavirus wey dem dey call variant don spread fast for London and south-East England.

Prime Minister Boris Johnson on Saturday introduce new tier four level of restrictions, im scrap di plan to relax rules over di Christmas period for millions of pipo.

Top health officials say evidence no dey say di the new variant dey more deadly, or go react differently to vaccines, but e dey show to be up to 70% more transmissible.

WHO say dem don detect di mutation for Netherlands, Denmark and Australia.

Which kontries don act and how?

Ireland goment announce say flights wey dey arrive from di UK would go dey banned for 48 hours at least from midnight, and "in the interests of public health, say make pipo for Britain, regardless of nationality, no travel to Ireland, by air or sea".

Ferry crossings for freight go continue.

Netherlands say dem go ban all passenger flights from di UK from 06:00 (05:00 GMT) on Sunday until 1 January.

Pending wen dem go fit get "greater clarity" on di situation for di UK.

Belgium dey suspend flights and train arrivals from di UK from midnight (23:00 GMT) Sunday. Prime Minister Alexander De Croo tell Belgian television channel VRT say di ban go dey in place for at least 24 hours and say na " precautionary measure", adding say "we go see later if we need additional measures".

For Germany, one order from di ministry of transport say planes from di UK no go dey allowed to land afta midnight on Sunday, although cargo go be exception. Health Minister Jens Spahn say dem never detect di UK variant yet for Germany.

France don suspend all travel links with di UK for 48 hours from midnight. E say dem go use di period to provide a more co-ordinated European response.

Spanish Foreign Minister Arancha González say Spain also want co-ordinated EU decision ontop di mata.

Austria dey also plan ban on flights from di UK, dem dey currently work out di details according to Austrian media.

Outside Europe, Israel don announce say anybody wey dey travel from UK must quarantine for two-weeks for hotel facility wey dem go pick.

2px presentational grey line

Wetin be dis new variant of coronavirus?

Dem first identify am for UK, in di middle of October from one sample dem taken for September.

Sabi pipo say e don show say di new UK variant dey spread faster dan di original virus - up to 70% more transmissible. But scientific details ontop di genetic changes, and how they fit affect di behaviour of Covid-19, no still clear.

Although e no show say di new variant go dey more resistant to already-developed vaccines, di mutation involve di spike protein of di virus.

Dis na di part wey dey help am to infect cells - and also di part dem design di vaccines to target. So although scientific experts don warn against false alarm response, dem also say e dey necessary to track di variant and try to stay ahead of di virus.