Coronavirus variant: Matt Hancock, UK Health Secretary say dem identify new form of Covid-19

Wia dis foto come from, Getty Images
UK Health Secretary Matt Hancock don tell MPs say dem don identify new variant of coronavirus wey fit dey associated with faster spread.
Health Secretary Matt Hancock say at least 60 different local authorities inside England don record Covid infections wey dis new form of covid cause.
He say di World Health Organization don dey notified and Porton Down dey do detailed studies about di mata.
Mr Hancock say "nothing dey to suggest" say e cause worse disease or say vaccines no go work again.
E tell MPs for di House of Commons say over di last week, sharp rise dey for di virus across London, Kent, parts of Essex and Hertfordshire.
"We no know di extent to which dis one be because of di new variant but no matter di cause we need to take swift and decisive action wey unfortunately dey absolutely essential to control dis deadly disease while dem roll out di vaccine."
Prof Alan McNally, expert for di University of Birmingham, say UK testing labs picked up on dis new variant in di last few weeks.
"Huge efforts dey ongoing to chook eye for di variant and understand di emergence. E dey important to keep calm and chook eye for di new form with rational mind as dis na normal virus evolution and we expect new variants to come and go and emerge over time."
End of Di one wey oda users dey read well well













