Ghana Election Special Voters list 2020: Voting in progress as Nana Akufo-Addo and John Mahama test popularity

Ghana Police, military, media, ambulance workers den essential service providers dey vote today ahead of 7 December 2020 election.
Dis be special voting exercise wey Ghana Electoral Commission organise for key service providers who dey give critical service to Ghanaians on 7 December.
Some 109,577 voters dey vote across de country from some 12 key institutions who de EC give dis right to vote first.
Voting start today at 7.00am wey e go end around 5.00pm this evening.
[Fotos of Ghana Election 2020 Special Voting in progress]






Wia dis foto come from, BBC Pidgin







EC dey use backup biometric devices in case of breakdown
Electoral Commission for Ghana dey use backup biometric devices in case equipment break down during de special voting exercise.
Ayawaso Central Electoral Officer for Gladstone Agboada, talk BBC Pidgin say dem get backup devices in case de devices mess up.

All de special voting centers get backup biometric devices to help make de process smooth.
Some 1063 voters dey take part in de special voting exercise for ATTC polling station, Ayawaso Central Constituency.
End of Di one wey oda users dey read well well
Officials divide de polling station into A and B so say traffic go flow smoothly for de voting center.
As at 9.35am officials talk BBC say dem record 200 votes, meanwhile more people dey queue inside dey wait for dema turn.
Ghana voting centers observe Covid-19 safety protocol during special voting

All 311 voting centers for Ghana dey observe COVID-19 safety protocol in de ongoing special voting exercise.
Electoral Commission of Ghana appoint COVID-19 ambassadors for de voting centers who dey ensure say voters wash dema hands, sanitize den stuff.

According to the Electoral Commission, the exercise is taking place at 311 designated voting centres located in all the 275 constituencies.
COVID-19 ambassador, Desmond Agyare for Osu Police Stattion which dey under de Korle Klottey Constituency talk BBC Pidgin say "I dey make sure everyone wash hands and sanitize."
"After I now go check dema temperature den make sure say dem wear nose mask before dem go meet electoral officers" he add.




![Ghana Presidential Election Results: Ghanaian Electoral Commission [EC] to declare Ghana Presidential Elections results by 5pm](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/5203/production/_115959902_churchresumptioninlagosstatelatestupdate-7.png.webp)







