See everitin wey happun during Ghana 2020 Elections
Ghana election 2020 latest news from BBC Pidgin as Ghanaians dey go to polls on Monday 7 December.
Live Coverage
Daniel Semeniworima and Princess Igho Williams
Una thank you!, Na here we go march break for de Ghana Election Live Coverage.
We leave una wit de declaration of de certified results of de Presidential Election 2020 from Ghana Electoral Commission.
And also enjoy our short video explainer of how Ghana Election de work.
From Daniel Semeniworima, Princess Igho Williams, Ronke Alo, Favour Nunoo and Gift Ufuoma una bye-bye!

Wia dis foto come from, Ghna EC
Wetin we call dis foto, Ghana Presidential Election Results 2020 Wetin we call dis Video, Ghana Elections 2020: Nana Akufo-Addo vs John Dramani Mahama election 2020 explainer For more other big-big stories from Ghana, Nigeria, Cameroon and other parts of West Africa go online to www.bbcpidgin.com and follow us on Twitter, Facebook and Instagram @BBCNewsPidgin
Watch President Akufo-Addo deliver im victory speech
Watch Ex-President John Dramani Mahama reject de results afta EC declaration.
What Mahama NDC talk afta Ghana presidential election results final announcement
Breaking, Ghana EC declare Nana Akufo-Addo as winner of presidential election

Wia dis foto come from, Getty Images
Nana Akufo-Addo of di New Patriotic Party don win di 2020 Ghana presidential elections, according to di kontri election office.
Di Ghana Electoral Commission announce Oga Akufo-Addo of di New Patriotic Party (NPP) as di winner, 48 hours after di 7 December election happen.
President Akufo-Addo win wit 51.59% wey represent 6,730,413 votes, according to di head of EC, Jean Mensa
Ghana EC declare Nana Akufo-Addo as winner of presidential election
EC Certified Presidential Result - Northern Region, John Mahama win Northern Region
John Mahama of de National Democratic Congress (NDC) win for de northern region wit 476, 550 votes.

Wia dis foto come from, Ghana electoral commission
EC Certified Presidential Result- Bono East Region, NDC John Mahama win
John Mahama of de National Democratic Congress [NDC] na im win for Bono East Region wit 213,694 votes.

Wia dis foto come from, Ghana Electoral Commission
EC Certified Presidential Result- Eastern Region
Nana Akufo-Addo of de New Patrotic Party (NPP) win Eastern region wit 752,061 votes.

Wia dis foto come from, Ghana Electoral Commission
EC Certified Presidential Result- Western North Region
John Mahama of de National Democratic Congress (NDC) win for de western north region wit 196, 556 votes.

Wia dis foto come from, Ghana Electoral Commission
Ghana EC declare 68.75 percent of de total Presidential election results

With 68.75 percent of de total certified results declared for Ghana Presidential Results, President Nana Akufo-Addo dey in early lead.
So far, Ghana EC don declare 11 Regions presidential election results.
Now na five more Regions results na im Ghanaians de wait for before dema fit know de official winner of Monday elections.
De declared be de following: Ashanti, Savanna, Western, Upper East, Ahafo, North East, Central, Upper West, Volta, Bono, Oti
John Dramani Mahama, de former president and Nana Addo Dankwa Akufo-Addo, de current president be de two main candidates
From de 11 declared results so far, Akufo-Addo clinch six: Ashanti, Western, Ahafo; North East; Central and Bono.
While Mahama take de rest five: Savanna,Upper East, Upper West, Volta and Oti.
Meanwhile see how things dey go for President Nana Akufo-Addo residence as dem dey wait for EC to declare de winner.
Wetin we call dis Video, Ghana presidential election results: Scenes from de residence of President Akufo-Addo NDC supporters dey jubilate for front of EC office






Akufo-Addo win big for Ashanti Region wey be Ghana large voting area
Breaking, EC Certified Presidential Result- Ashanti Region, NPP Nana Akufo-Addo win
Nana Akufo-Addo of de New Patrotic Party [NPP] na im win for Ashanti Region.

Wia dis foto come from, EC
Breaking, EC Certified Presidential Result- Savanna, NDC John Mahama win
National Democratic Congress [NDC] Candidate, John Dramani win Savanna region.

Wia dis foto come from, EC
Breaking, EC Certified Presidential Result- Western Region, NPP Nana Akufo-Addo win
New Patrotic Party [NPP] Candidate, Nana Akufo-Addo na be de winner of de Western Region.

Wia dis foto come from, EC
Breaking, EC Certified Presidential Result - Upper East Region, NDC John Mahama win
National Democratic Congress Candidate [NDC], John Dramani Mahama win for Upper East Region.

Wia dis foto come from, Election Ghana
Breaking, Ghana 2020 Presidential Election Results
Ghana Police caution people wey dey jubilate on top election result

Wia dis foto come from, Ghana Police
Police for Ghana don caution people wey dey jubilate on top de certified election results wey EC don declare to do am with care and consider others wey no dey happy.
Ghana Police Service dey give dis warning as de entire country dey wait for di final result of de presidential election wey de country do 7 December.
De police talk for one tweet say;
“As de collation is ongoing, let de jubilant jubilate sensitively: keeping in mind that others fit dey very sad and can act without thinking when anybody tease them.”

Wia dis foto come from, Ghana Police
Five people die for Ghana election violence
Breaking, Presidential Election Results latest update from Ghana EC, .

Wia dis foto come from, Ghana EC
Nine Regions presidential election results na im Ghanaians de wait for before dema fit know de official winner of Monday elections.
Latest from Ghana Electoral Commission na say de EC Officials dey continue to undertake what dema call a robust and participatory counting process of de results for de National Collation Centre inside Accra.
Dis be to ensure accuracy and transparency of de Presidential election results, according informate de Ghana EC share with BBC Pidgin on Wednesday morning.
Ghana Electoral Commission thank de public for dia patience and pray dema allow peace reign.
Currently, EC Ghana don certify and declare 43.75 percent of de total provisional presidential results from de 7 December election wey happun for Ghana
Ghanaian Electoral Commission [EC] declare seven of de 16 Regions presidential election results
De declared be de following:Ahafo, North East, Central, Upper West, Volta, Bono and Oti
John Dramani Mahama, de former president and Nana Addo Dankwa Akufo-Addo, de current president be de two main candidates
From de seven declared results so far, Akufo-Addo clinch four: Ahafo; North East; Central and Bono.While Mahama take de rest three: Upper West, Volta and Oti.


