Boko Haram attack: Rice farmers decapitation 'massacre' for Borno, village burial vex Nigeria social media users as UN say death toll high

Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Twitter/@dawisu

Borno Rice farmers murder village victims of suspected Boko Haram attack enta six feet on Sunday afta di dem suffer slaughter [decapitation] during di attack near Maiduguri, Borno state northeast Nigeria.

At least 110 civilians na im dem kill and many odas wound inside one attack on farmers for northeast Nigeria.

UN resident and Humanitarian coordinator Edward Kallon, reveal dis tori for statement on Sunday.

Tori be say attackers cut throats of dis rice farmers wey only go find wetin to chop for dia agriculture fields inside northeastern Nigeria.

Earlier BBC Pidgin bin report say na 43 rice farmers dem kill but Zabarmari villagers for Borno say dem no fit tok di exact number of pipo wey di suspected Boko Haram attackers slaughter for di rice farm.

Now, Nigeria social media dey catch fire on top di killing of dis rice farmers wey dey dia farms dey harvest rice on Saturday.

On Saturday, di militants attack di farmers wey bin dey harvest rice farm for Zabarmari, Mafa local goment.

Govnor Babagana Zulum lead di burial prayers for forty three farmers wey Boko Haram militants kill on Saturday. Residents say nobody still fit tok exactly how many pipo die for di attack.

Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Borno State Government House

Tok tok pesin for di community tell Govnor Babagana Umara Zulum, wey lead di burial of di farmers say, as tins be now nobody still fit tok exactly how many pipo die for di attack.

According to Amnesty International, inside di pipo wey die, 10 na women wey dem neva sabi who dem be, wey bin dey work for di rice farm, while sixteen of dem na refugees.

Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Borno State Government House

Wetin pipo dey tok

Boko Haram killing of innocent pipo don dey go on for more dan 10 years, but in recent times Nigerians as well as pipo from around di world don dey tok more and more about about di mata as e be like say di killing no get ending.

While some pipo dey blame Buhari goment for doing rehabilitation programme and releasing many of di militants unto say dem don "repent."

Odas feel say goment need to do more serious military attacks to fight di insurgents.

Anoda set believe say goment must to first tackle poverty and illiteracy first before dem go fit arrest di situation for di region.

Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Imam of Peace tweet
Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Emeodi Mba tweet
Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Amnesty International tweet
Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Aproko Doctor
Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Aisha Yesufu tweet
Boko Haram attack: Borno rice farmers murder, village victims of decapitation

Wia dis foto come from, Screenshot/Twitter

[Gov Babagana Zulum reaction to Borno rice farmers murder]

Govnor Babagana Zulum don ask for more young pipo to join bodi do vigilante to help fight insurgency inside di northeast region.

Professor Zulum suggestion appear to raise concerns about wetin be like lack of confidence ontop Nigeria army and di work dem dey do.

Di Borno govnor visit di victims community for Zabarmari on Sunday morning wia village pipo show am di deadi bodi of 43 rice farmers before dem bury dem.

Burial of di 43 farmers wey Boko haram kill for dia farm

Wia dis foto come from, @GovBorno

Wetin we call dis foto, Govnor Babagana Zulum lead burial prayer

Him tell tori pipo say residents of di state dey face double wahala alias dilemma - either risking being killed ontop dia farms or dying of hunger while staying at home for fear of attacks.

Background of di attack [Borno rice farmers murder, village victims of decapitation]

No group don come out to claim responsibility for di killings. Di Islamist groups, Boko Haram and di Islamic State West Africa both dey active inside di northeast region of Nigeria.

Di authorities inside Borno state say dem dey search for di attackers.