You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lekki toll gate, Lagos Nigeria: Yemi Osinbajo speak on EndSARS protest shooting
Nigeria Vice President Yemi Osinbajo on Wednesday night finally speak on di Lekki toll gate shooting during #EndSARS protest.
"My heart go out to all di victims of di Lekki shootings, and also di policemen and all oda men and women wey lost dia lives in di past few days in different parts of Lagos & oda states."
Na di message Vice President Yemi Osinbajo write for im official Twitter page to calm Nigerians down afta Tuesday night Lekki toll gate shooting wey kill at least 12 pipo, according to investigations by Amnesty International.
Dis na di first time any pesin from President Buhari office alias presidency go speak 24 hours afta di killings wey happun wen armed sojas open fire at protesters.
"We pray say we go ever see a repeat of dis tragedies...." Di Vice President tok.