Meet "Halima Yusuf" wey Femi Fani Kayode call im 'comforter'

Wia dis foto come from, Femi Fani Kayode
E no longer be news say former minister of aviation Femi Fani Kayode don come out to deny say e don marry new wife.
According to di politician e no marry any new wife and di lady in question Halima Yusuf na just im close friend and comforter.
- See beta beta Independence Day Nigeria pictures and wishes
- President Buhari 'Nigeria At 60 speech' insist on petroleum price increase - See key messages from di Independence Day broadcast
- Police gbab Nigerians wey protest for Lagos, oda parts of Nigeria on Independence Day
- Check out why Google Doodle honour Nigeria 60th Independence Day
Na dis one make many pipo dey ask who be Halima Yusuf.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
See wetin we know about Halima Yusuf
From wetin BBC News Pidgin gather, Halima na from Borno State for northe astern Nigeria but live for Gombe state wit her family for most of her life before moving to Abuja in di last couple of years to start business.

Wia dis foto come from, Halima Yusuf
Halima wey her nickname na 'Leemah' describe herself for her instagram page as Chief Executive Officer of Sly Royal wia she dey sell female clothing and oda accessories especially ones wey northern Nigeria women dey wear (Abaya etc).
Di same instagram profile add say she dey control anoda business Leemah's secrets wia she dey sell beauty and make up products.

Wia dis foto come from, Halima Yusuf
For some posts wey she do for instagram she call on pipo wey get bad skin to talk to her for help.
End of Di one wey oda users dey read well well
Her age and wia she go school no dey clear at dis time and pipo dey also expect Halima to tok about her relationship with Femi Fani Kayode after di minista tok im own.















