Laycon Big Brother Naija winner: Olamilekan Agbelesebioba first interview afta 2020 BBNaija show, LIRS tax notice plus Govnor Dapo Abiodun hailing

Wia dis foto come from, Screenshot/BBNaija
Olamilekan Agbelesebioba AKA Laycon, di Big Brother Naija winner say di entire Big Brother Naija season 5 experience still be like feem to am.
Di Big Brother Naija winner add say im dey surprise by some beautiful friendships wey im no expect and im bin think say na Dorathy for win.
Laycon wey don get over a million Instagram followers afta e win, say im never tok say Erica na bad pesin.
Na Ebuka Obi-Uchendu, di host of di Season 5 BBNaija show na im do di interview.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Meanwhile Laycon receive special hailing from Govnor Dapo Abiodun of Ogun State, plus LIRS tax notice, just 24 hours afta di 26 year old win di star prize.
"I dey happy to congratulate one of our own in Ogun State, Olamilekan Agbelesebioba, AKA @itsLaycon for emerging winner of @BBNaija Lockdown."
Our Administration go continue to support and empower di youth through different channels, towards inclusion, job creation, and di utility of our natural youthful energy." Di govnor add.

Wia dis foto come from, Dapo Abiodun
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
On di oda hand, di tax office for Lagos State where Laycon dey base, LIRS send am coded tax notice as dem congratulate am.
End of Di one wey oda users dey read well well
As dem hail am dem tell am say dem dey expect am to pay im tax for 2021 as winner of di N85m prizes from di TV reality show.
















