September: 2020 movie release go see five 'correct' feems drop dis month

September 2020 movie release: Tenet star

Wia dis foto come from, Warner Bros

Wetin we call dis foto, Christopher Nolan (The Dark Knight) na im direct dis movie Tenet wey star black man as di lead actor
Read am in 3 mins

As many kontris across di world dey open up cinemas to di public again, September 2020 go see di release of Tenet and - finally - di remake of Mulan, along with King's Man part three.

Online streaming platforms like Netflix don even make am easy for pipo to watch latest feems - like how dem premier di 2020 action-thriller Extraction on am, wey later break records.

Di feem wey feature Chris Hemsworth suppose show normally for cinemas but di pandemic no allow.

And important Nigerian entertainment cities like Lagos sef don dey ready to open cinemas, so dis one go sweet some pipo belle.

Skip YouTube post, 1
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post, 1

Tenet

If any film go really drag pipo enta cinema again, e go be Christopher Nolan blockbuster feem Tenet. Di feem wey star John David Washington na science-fiction about one secret agent wey discover mysterious weapons wey fit take pesin back in time.

Di man wey dey behind di weapons na one bad Ukrainian weapons dealer wey Kenneth Branagh (Valkyrie) play.

According to IMDb, e go begin show for Nigeria on 4 September.

Skip YouTube post, 2
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post, 2

The King's Man

Director Matthew Vaughn go nack fans of im first two 'James Bond' Kingsman comedy-thrillers with part three.

Although for dis new feem im take di plot to World War One wia one cabal of criminals wan put di world for trouble. E star big-big name for Hollywood like Rhys Ifans, Ralph Fiennes, Stanley Tucci and Djimon Hounsou.

Release date na 16 September for di UK, Ireland and France; 17 September for Germany, Denmark and Italy; and 18 September for US and Taiwan.

September 2020 movie release

Wia dis foto come from, Disney

Wetin we call dis foto, Mulan na cartoon wey popular many years ago

Mulan

Skip YouTube post, 3
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post, 3

Some go remember di Disney 1998 cartoon about di Chinese girl wey pretend to be man so as to join di army. Dis remake na human beings act inside am.

But di feem unfortunately go be di first major one to go straight to Disney+ wey be like Netflix. To be released from 4 September.

September 2020 movie release

Wia dis foto come from, Netflix

Wetin we call dis foto, The Babysitter: Killer Queen feature popular comic actor Andrew Bachelor

The Babysitter: Killer Queen

Di movie star di popular comedian Andrew Bachelor, Bella Thorne and Robbie Amell for dis part two feem wia di main actor need to find way defeat one evil pesin.

Na Netflix go release dis one for 10 September.

Kajillionaire

Skip YouTube post, 4
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post, 4

Kajillionaire na feem about how jaguga (419 fraud) man and woman raise dia 26 year old daughter to sabi how to thief from pipo for Los Angeles, yet di family still dey poor.

But wetin happun when dem decide to add one more pesin to dia gang?

Release date na 18 September for US, and 9 October for UK.

Normally di same release date for US big films na im Nigeria, Kenya and South Africa dey use.