Chadwick Aaron Boseman death: Colon cancer causes cut Black Panther actor and Taylor Simone husband life - Symptoms wey dey cause colon cancer wey end King T'Challa #WakandaForever journey dey here

Read am in 3 mins

Colon cancer na cause Chadwick Aaron Boseman death wey cut di 'Black Panther' hero King T'Challa #WakandaForever journey on earth.

Di death of American actor, Chadwick Boseman don shake pipo all ova di world as many pipo don begin search wetin be colon cancer wey kill di Black Panther hero for di age of 43.

Doctors bin diagnose Boseman with stage three colon cancer four years ago before di disease kill am afta e progress to stage four of dis type of cancer.

Sake of dis, pipo don begin search, read and tok about wetin dis colon cancel be and wetin be di symptoms. So BBC Pidgin don breakdown di signs, symptoms & cause of colon cancer just for you to sabi.

Wetin be Colon Cancer?

According di website of UK National Health Service (NHS), Bowel cancer na general term for cancer wey begin for di large bowel. Depending on where di cancer starts, dem dey sometimes refer to bowel cancer as colon or rectal cancer.

For UK Bowel cancer na one of di most common type of cancer diagnosed. Most pipo wey doctor diagnose with am dey ova di age of 60.

Wetin be bowel/colon cancer symptoms?

  • Persistent change in bowel habit - Di pesin go dey poo more and di poo fit also become watery
  • Continuous present of blood inside stools without no reason
  • Persistent lower abdominal (tummy) pain, discomfort or bloating- wey dey happen by eating and sometimes e fit dey associated with loss of appetite or weight loss.

Causes of bowel cancer

According to di UK National Health Service, di exact cause of bowel cancer no dey know yet but e get some number of things wey fit increase your risk and dem include:

Age - almost 9 in 10 pipo with bowel cancer dey aged 60 or ova

Diet - diet wey dey high in red or processed meats and low in fibre fit increase your risk

Weight - bowel cancer dey more common for overweight or obese pipo

Exercise - If pesin dey inactive, dat na no dey do exercise at all e fit increases im risk of getting bowel cancer

Alcohol - drinking alcohol fit increase your risk of getting bowel cancer

Smoking- smoking fit increase your chances of getting bowel cancer

Family history - having close relative (mother or father, brother or sister) wey develop bowel cancer under di age of 50 fit put you at greater lifetime risk of developing di condition.

Some pipo also get increase risk of bowel cancer because dem get anoda condition, like extensive ulcerative colitis or Crohn's disease for di colon for more than 10 years.

Also, according to one study wey dem publish for di journal Nature, one common type of gut bacterium fit increase pesin chance of developing bowel cancer.

Di bacterium na one type of E. coli infection, wey dey present for up to one in five pipo, scientists believe. E dey release one toxin wey experts tok say fit damage di cells wey line di bowel, and wey fit turn some cells cancerous ova time.

Experts neva know yet how many of dis fit dey link to di E. coli strain wey dey make di toxin colibactin.