You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Chadwick Boseman death: Black Panther star, 'King T'Challa' wey die of colon cancer receive tributes from Hollywood, Marvel family and rest of di world
World leaders, Stars from Marvel Cinematic Universe and across Hollywood plus fans don begin pay tributes to Black Panther star, Chadwick Boseman wey die of cancer.
Di US actor wey be 43 years old die for im house for Los Angeles with im wife and family by im side.
Hollywood directors, writers, actors, actress, world leaders and oda ogbonge pipo no fit hide dia shock afta dem receive dis news of Boseman death.
Director Jordan Peele tweet say dis news na 'crushing blow.'
Former US president, Barack Obama recall how Chadwick come white house to work with children during wen im dey play Jackie Robison role for one film. Obama add say Chadwick dey 'Blessed' and 'gifted.'
Di Academy of Motion Picture Arts and Sciences write for Twitter say 'Chadwick Boseman bring strength and light to di screen, every time.'
While American entertainment company wey produce di Black Panther , Marvel Entertainment say im death break dia heart.
Meanwhile US Democratic presidential nominee for di 2020 election, Joe Biden write say 'Boseman dey bigger than anything wey pipo see for screen... and im don inspire generations and show dem say dey fit be anything they want'
End of Di one wey oda users dey read well well
Kamala Harris wey be Democrat vice presidential nominee for 2020 election also tweet say she dey 'heart broken say her friend and fellow wey dey brilliant, kind, learned and humble don die.'
America actor Chris Evans say Chadwick dey special and im death dey more than heartbreak to am.
Oprah Winfrey write for Twitter say Boseman na "gentle gifted SOUL wey show us all dat greatness in between surgeries and chemo..."
See more tributes from celebs dem here;