Abdullahi Ganduje: Kano elders report Gov. Ganduje to President Muhammadu Buhari

Govnor Abdullahi Ganduje

Wia dis foto come from, Twitter/@dawisu

One group of activists for Kano don cari di state govnor Abdullahi Ganduje go report to Nigeria president Muhammadu Buhari unto say im wan borrow moni from one Chinese bank tak build railway line.

More dan 15 groups wey gada dem sef under one join bodi, wey dem call di Kano Forum, say di plenty loan wey di govnor wan collect to take construct di first phase of di railway line for di state no make sense especially wit all di penti wahala wey di state dey face.

Di group claim say govnor Ganduje go chop gbese of 684 million euros wey dem go take 50 years to repay.

Chairmo of di group, Bashir Othman Tofa say, "e go almost dey impossible for Kano state to bear dat kain debt add to di one wey dem don collect before."

Oga Tofa say dem go cari di govnor go court if im decide to collect di loan.

"Di join bodi go also take any action wey di law permit am to make stop Kano state goment from implementing di Kano railway project," na so di group tok for statement.

Dem add say di dept go put di pipo of di state for difficult situation.

Dem say instead of building long line, make goment use di loan di loan to build increase classrooms plus school facilities and build more schools for di state.

But Kano state Commissioner for information, Muhammad garba say dem no go stop di project.

Im add say di group na minority and dem no dey speak for Kano pipo.

Tori be say na sake of dis same project govnor Ganduje remove di former Emire of Kano becos im criticise im plan.

Recently, members of di Kwanwasiyya group, wey dey support di former govnor Rabiu Kwankwaso, don cari govnor Ganduje go court to try stop am from borrowing 300 billion naira from China.