Megan Fox and Machine Gun Kelly: What you need to know about Colson Baker, di rapper di Hollywood actress fall in love with

Wia dis foto come from, Getty Images
On Tuesday, Machine Gun Kelly (wey im real name na Colson Baker) share selfie with Megan Fox , di couple wrap dia arms around each oda as dem pose with dia tongues out.
"I wait for eternity to find you again..." na wetin im caption di photo wey im post for social media.
Dis na di latest ontop di Hollywood couple relationship mata afta dia first joint interview together.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
For dia recent interview on July 22 for di Give Them Lala…With Randall podcast, both Megan and Machine Gun Kelly tok about dia romance wey first start for di set of di upcoming movie titled Midnight in the Switchgrass.
"Our trailers dey next to each oda so I go wait outside for my trailer steps everyday," na wetin Machine Gun Kelly tok. "She get di most gorgeous eyes I don ever see." Na wetin im add put
Megan, wey recently separate from husband Brian Austin Green, say, "Anytime wey me and am dey inside room and I greet am come look into im eyes. I know straight away say im be my twin. Two of our souls na di same I think. I tell am almost immediately."
Who be Machine Gun Kelly?
Dem born Machine Gun Kelly wey im real name na Colson Baker for 22 April 1990 for Houston, Texas, United States.
Colson Baker, wey pipo sabi professionally as Machine Gun Kelly, na American rapper, singer, songwriter and actor from Cleveland, Ohio.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im don release five studio albums throughout im career. As actor, Baker first feemwey im act na for 2014 romantic drama Beyond the Lights.
Di singer get 10 year old daughter, Casie Colson Baker.











