Scientist don fin one big black hole wey dey larger than di size of our entire Solar System

Wia dis foto come from, EHT
Astronomers don take di first ever pishure of one black hole, wey dey for one galaxy.
Di measure of di black na 40 billion km across - dat na three million times di size of di Earth - and scientists don describe am as "a monster".
Di black hole dey 500 million trillion km away and na network of eight telescopes across di world snap im foto.
Dem don publish informat about di black hole inside Astrophysical Journal Letters on Wednesday.
Prof Heino Falcke, from Radboud University inside Netherlands, wey come wit di idea of di experiment, tell BBC News say dem see di black hole for one galaxy we dem call M87.
"Wetin we see dey larger than di size of our entire Solar System," e tok.
"E get mass 6.5 billion times dat of di Sun. And na one of di heaviest black holes wey we think say dey exists. Na big monster, di heavyweight champion of black holes for di whole Universe."

Wia dis foto come from, DR JEAN LORRE/SCIENCE PHOTO LIBRARY
Di image show very bright "ring of fire", as Prof Falcke describe am, wey surround one perfect circular dark hole. Wetin cause di bright halo (circle) na superheated gas wey dey fall enta di hole. Di light dey brighter than all di billions of oda stars inside di galaxy combine togeda - dat na why we fit see for far distance from Earth.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di edge of di dark circle for di centre na di point wey di gas from enta di black hole, wey be object wey get large gravitational pull, not even light fit escape.
Dis first image go make researchers to learn more about dis mysterious objects. Dem go dey interested to look out for ways wia e be say di black hole dey depart according to wetin dem expect for physics. No-bodi really know how dem create di bright ring around di hole . Di kwesion wey dey surprising pass na wetin go happun wen object fall enta inside black hole.

Wetin be black hole?
- Black hole na region of space from which notin, not even light, fit escape
- Upon di name, dem no dey empty but instead dem get huge amount of matter wey dey gada plenti inside one small area, to give am very big gravitational pull
- E get region of space beyond di black hole wey dem call di event horizon. Dis na "point of no return", beyond which ie dey impossible to escape di gravitational effects of di black hole













