Elon Musk Falcon Heavy rocket blast enter space, no shaking
US entrepreneur Elon Musk don launch im new rocket, di Falcon Heavy, enter space from di Kennedy Space Center for Florida.
Di giant moto- wey get power pass any oda shuttle - lift comot from ground with no palava as in rise over di Atlantic Ocean.
Before dem launch di rocket, many believe say test flight dey very risky.

Wia dis foto come from, SPACEX
Di SpaceX CEO, Musk talk say di challenge wey dey to build new rocket system mean say di chance say im go dey successful na like 50-50.
"For my mind, I dey see say big explosion go happen, tire go roll comot ontop road. But fortunately no be wetin happen be dat," im tell reporters after di event.
Now wey dis launch don happen, di Falcon Heavy na im reliable pass for di world as big rocket.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem design di Falcon Heavy so dat e go fit carry up to 64,000 kg enter space - dis na like say make you carry five London double-decker bus enter space.
Musk say im rocket fit carry double di load wey one rocket Delta IV Heavy fit carry, and di cost less, like 30% of am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Because di experiment dey risky, dem decide not to carry too much load - dem carry Musk old red Tesla sports car.

Wia dis foto come from, SPACEX












