Cardi B: Offset do video confession say e want im wife back as Christmas gift

Cardi B for show

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, America rapper, Cardi B don already comot her husband ring for her hand.
Read am in 1 mins

Cardi B husband, wey dem don separate, rapper Offset enta Instagram Saturday morning to beg say e want im wife back as birthday wish.

Na wetin im tok for im birthday wish, say e no say e no do am well but ee wan spend Christmas and di rest of im life wit her and dia pikin, Kulture.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Cardi B comot on Deecember 5, tok say she dey leave Offset (di papa of dia pikin) on top say "love don finish for dia side" for Instagram video wey she don delete.

But e no too tay, wey pesin wey tok say she bin dey sleep with Offset, comot tok sorry say "she bin no know how serious dia marriage bin dey".

Cardi B and Offset bin marry for September of 2017 and born dia first pikin for June dis year.

Di American rapper for new photo don already comot di ring wey Offset bin use propose to am for October last year.

Tori be say dem bin don already marry for September 2017 before di public engagement for October - Na Cardi B herself announced say dem secretly marry before she born her pikin.