You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Trump News: US President say Google dey rig bad search result
US President Donald Trump dey accuse Google say dem dey rig result wen pipo search 'Trump news'.
E say di search engine dey put negative tori from pipo wey im say be "national left-wing media" above oda pipo own.
But Google don deny say dem dey use politics sense dey arrange search results.
Mercedes Bunz, one senior lecturer fo digital technology for King's College London, say e no possible say Google go do dat kain.
"But e fit rank web pages high pass wetin pipo dey link to."
Oga Trump say 96% of tori wey pipo dey search wit 'Trump news' dey always show negative tori wey left-wing tori pipo do.
Di presido no mention wia im get dis number but The Verge put am for dia website say e be like say na from Paula Bolyard tori wey she write for conservative news site PJ Media.