You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Trump "shithole" comment: Africa leaders dey react
Some Africa leaders don invite US ambassadors for dia countries to come explain wetin dia president Donald Trump really mean on top di "shithole" mata.
Nigeria, Ghana and South Africa on Monday summon di US official for dia different countries over word wey president Trump talk; tori be say Trump call Haiti, El Salvado and Africa shithole countries.
South Africa say dem go do official protest to US embassy for Pretoria. Di idea na to give "opportunity to di Charges de' Affaires to explain di statement."
Botswana bin don first invite di US ambassador to di country to come "clarify if Botswana follow for di shithole country."
Ghana president Nana Akuffor-Addo enter Twitter speak im mind with strong face say: "we no go accept dat kind insult."
US embassy for Ghana sharply enter Twitter to talk how dem get "great respect" for Africa people.
Africa Union don chook mouth for di mata. Dem say make di US president take back im word, and im must apologise for di talk.
Oga Trump bin say, even though im use tough language, no be like so im talk am. But di wahala be say Trump mention only Haiti for im denial statement.
End of Di one wey oda users dey read well well