Pope Francis don beg say make pipo forgive di Church

Pope Francis

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Pope Francis don say sorry to all di victims wey don suffer sexual abuse from Catholic priests dem.

E tok am for Marian Shrine for Knock, as e dey do im second day wey im dey visit Republic of Ireland.

Di Pope bin do meeting wit eight pipo wey suffer di abuse.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

E tok say nobodi dey dis world wey no go shake on top di tori of pipo wey don "chop abuse, tear eye from small and painful memories wey still dey dia bodi".

Na di first time wey Pope dey visit di kontri in 39 years. Di last time na Pope John Paul bin go for 1979.

On Sunday, dem dey expect say 500,000 pipo go gada for park for Dublin as di Pope do Mass to celebrate di World Meeting of Families.

CROWDS GATHER AT KNOCK
Wetin we call dis foto, Marian shrine na place wey pipo say dem bin see Mary appear for August 1879.

Irish Prime Minister (Taoiseach) Leo Varadkar bin draw ear give di Pope say make e handle di mata of sex abuse and how di church dey hide am.