Pope Francis surprise flight workers as im marry dem for plane

Pope Francis marry flight attendants for Chile

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di couple ask di Pope make im bless dia marriage, but Pope get other plans
Read am in 1 mins

Pope Francis don make history after im marry two flight attendants for plane wey dey fly 36,000 ft for Chile airspace.

Paula Podest Ruiz, 39, and Carlos Ciuffardi Elorriga, 41, don do marry for registry already when dem ask Pope to bless dia marriage.

"You wan make l marry una?" na wetin di Pope ask dem.

Di couple talk say na 2010 earthquake wey spoil dia church for Santiago, Chile capital no make dem do white wedding.

Pope Francis talk say im ready to marry dem during im short flight from Santiago to Iquique, northern Chile.

Pope marry flight attendants for Chile

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Carlos Ciuffardi Elorriga and Paula Podest Ruiz as dem kiss after di service

Pope do di Catholic wedding service for di couple, wey include di oga for di airline wey act as dia witness.

One Cardinal wey waka with di Pope for im trip around Chile, use im own hand, write di paper wey di bride, groom, and witness sign.

One American journalist, Steve Dorsey with CBS News, show di paper for social media.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post