You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Thai cave rescue: Four more boys don comot, but dia coach, four odas still dey inside cave
Rescuers for Thai cave don comot four more boys from di cave as di operation to comot dem don enta di second day.
Di Thai Navy Seals wey dey lead di operation don tok say na eight boys in total dem don comot from di cave.
Four boys and di coach still de four inside di cave.
Tori be say, dem dey comot di boys wey no too strong for di cave first.
Tori be say dem dey di field hospital near di cave, according to di rescue officials.
But e no tey afta when BBC Tori pesin wey dey wia di rescue dey happen say ambulance wey dey blow sirens just drive comot from di area.
Tori bin comot today say some of di boys wey trap inside di cave fit comot dis afternoon as officials say e fit reach three days to rescue evribodi.
E don reach 14 days since di 12 boys and dia coach bin trap inside di cave afta dem bin go celebrate birthday.
End of Di one wey oda users dey read well well