Kanye West suggest say African-American slavery happen by 'choice'

US rapper Kanye West,

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Kanye West na strong supporter of Donald Trump
Read am in 2 mins

US rapper Kanye West say di slavery wey African Americans suffer wey happen over hundreds of years ago, fit don happen by "choice".

"Wen you hear about slavery for 400 years ... for 400 years? Dat one sound like say na dia choice," im talk wen im appear for entertainment site TMZ.

Kanye West don dey news recently because of im strong support for President Trump.

Dem use force take carry Black pipo from Africa go US during di 17th, 18th and 19th centuries and sell dem as slaves.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Presentational white space

Kanye later tweet say im comments on Tuesday dem don misinterpret am and say im "bring up di 400 years point because we no fit dey mentally imprisoned for anoda 400 years".

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Im tell di pipo wey dey interview am say "right now we dey choose to dey enslaved", wey come vex one black member of staff for di company, Van Lathan.

Oga Lathan say wetin di rapper talk be like im no get sense.

"You get right to believe anytin you want, but fact dey and real-world dey and consequence dey behind everitin you just talk," im add.

Wetin Kanye talk don make plenty pipo to ginger for social media.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

Skip X post, 5

End of X post, 5

Presentational white space

Dis one wey im talk dey come afta im release song wia im defend as im take support Donald Trump, wey im say dey "fight for di pipo".