You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Gold bars just dey rain comot airplane for Russia airport
E shock pipo as dey see gold dey rain down for one airport for east Russia.
One plane bin dey transport gold-silver alloy dey go when di container wey dem put am break, come make plenty gold rain down for di runway.
E reach like 200 gold bars wey scatter all over di runway of Yakutsk airport for Siberia.
Na one Canadian mining company get am and dem don talk say dem don gather all di gold wey scatter.
Police don launch investigation into di mata.