Serena Williams don share baby picture

Wia dis foto come from, Instagram/@serenawilliams
US tennis star, Serena Williams, don post di first photo of her daughter, Alexis Olympia Ohanian Jr.
She post am on top social media, almost two weeks after she born di pickin.
Williams and her fiancée, Alexis Ohanian, wey be co-founder of Internet company Reddit, bin welcome their baby girl for 1 September inside clinic for Florida, US.
Di 23-time Grand Slam winner share video clip on top her Instagram stories, Facebook and even her website.
Williams announce di name of her baby daughter with her Instagram stories profile.
She also share different times during her pregnancy, including di time when she win di Australian Open while she get belle, and her first ultrasound for doctor office.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Getty Images
Her Instagram picture of di baby don get more than 426,000 likes since she post am (as at di time we dey write dis tori).
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images
Early dis year, Williams win her 23rd Grand Slam tournament for di Australian Open while she dey around eight weeks pregnant.
According to her coach, she hope to return to work wey be say she go dey in time to contest for next year Australian Open.
Na for December 2016, na im Williams use Reddit to announce say she don engage to Mr Ohanian.
Na Paul Harrison, UGC and Social news team for BBC report dis tori











