Sharapova: 'I make Serena Williams cry'

Wia dis foto come from, Julian Finney
US tennis player Maria Sharapova don write new book, and one of things wey dey inside am na di bad-belle wey dey between her and Serena Williams.
Maria Sharapova return to tennis dis April, after she do 15 months punishment, on top illegal drugs wey dey her bodi, to make her play well-well for tennis competitions.
Di book start from di time when she enter wahala over di illegal drugs, and e full di book till di end.
But one of di things wey don make people all over di world dey talk, na wetin she write about Serena Williams, di tennis star wey just born her first pickin.
For dis book wey she call ''Unstoppable: My Life So Far,'' Sharapova no shy at all.
People Magazine for US wey don read di book say, Sharapova write dis: "me and Serena suppose be friends, because na di same kind thing we dey get mind for. But we no be friends; I feel say we dey inspire each other."

Wia dis foto come from, Kevork Djansezian
Sharapova open all her mouth, talk about di time she nack Williams for Wimbledon final, come win di women's title for di first time.
Later dat day, Sharapova say she see Williams for changing room, as water dey flow like tap from her eyes.
End of Di one wey oda users dey read well well
Sharapova say: ''I quickly comot, because l no wan make she see me, but e don already late."
Sharapova feel say dis defeat and di crying wey she see pain Williams, so tay Williams decide to become di best woman tennis player for history.
''l feel say Serena no like me because l be person wey no get body like dat, but like film trick I beat her for Wimbledon. Di bad blood come reach gear five, after l hear her dey cry."

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images
Sharapova add say dis same situation come make Williams hate her, because she hear when Serena tell one of her friend say she no go ever allow Sharapova beat her for tennis again.
"When people dey wonder why e dey always hard me to beat Serena because she don beat me 19 times, while me don win her only two times...to me, di answer na wetin happen for that locker room."
Sharapova say e fit dey possible for future say both of dem go do friend-friend with each other, after dem retire.
Her book suppose come out on September 12, after dem for don finish di US Open for dis year.
Williams don win 23 Grand Slams now, something wey be big record for tennis, while Sharapova don win just five in total.

Wia dis foto come from, Mike Hewitt










