Israel-Palestine conflict 2023: Pikin dem dey among pipo wey die from strike as dem dey run away from Gaza
- Author, Paul Brown & Jemimah Herd
- Role, BBC Verify
Warning: Dis article contain details wey fit do some pipo one kain
Reports first comot on Friday evening of one strike on a convoy of vehicles wey dey head towards southern Gaza. Dis vehicles bin dey carri civilians wey dey rn from northern Gaza afta Israel di Israel Defence Forces (IDF) bin issue one evacuation order.
Videos wey show di mass destruction for di scene emerge afta.
BBC Verify don confirm say di strike happun on Salah-al-Din street, wey be one of two evacuation routes from northern Gaza to di south.
Wetin di footage show?
Di longest video we don verify dey too horrible for us to show. Na scene of total mass destruction. We see as men dey run towards one truck dey yell prayers and lament into di smoke-filled air. Sirens and car alarms dey make noise throughout.
As di camera move closer to di truck, di extent of di destruction become clear. Deadi bodi dey twisted and mangled and dem dey scattered evri wia.
Later, di broken body of one small boy wey dem dressed in shorts and a T-shirt lie on di truck, im head dey twisted awkwardly towards di camera.
We count at least 12 deadi bodi among di wreckage. Most of dem na women and pikin dem - some of dem appear to dey around two to five years old.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oda footage show di deadi bodi of victims lying for di street. Vehicles dey burn and dia drivers and dia passengers still fit dey inside dem.

Wia dis foto come from, .
Verifying di aftermath
A number of videos don come out on social media showing di immediate aftermath of di strike.
Local media reports tok say di attack take place on Salah al-Din road, one major highway wey runs north to south across di strip, and one of just two evacuation routes for civilians wey dey live for di north.
The road dey full of traffic all day on Friday as Gazans wey dey live for di north listen to Israel warnings to vacate di area.
We begin by verifying di first video, wey show di devastating aftermath of di attack. We focus our attention on dis 45km-stretch (28 miles) of road, beginning wit di north, sake of say na dia di convoy fit begin dia journey from.

As well as di scenes of death and destruction, di video also bring some key details - buildings, road markings, signs - wey offer clues to di location.
We make use of freely available satellite imagery to look along dis road and search for areas wey match di details wey we see. We place di location a few kilometres from di southern outskirt of Gaza City
We perform a reverse-image on certain keyframes for di footage to ensure say di material na fresh material, so we go know say no be somtin wey dem repost from incident wey don happun before now like wetin dey always shele for social media.
Finally, we use online tools wey identify di angle of sunlight and length of ensure say dem film di footage at 17:30 local time (14:30 GMT) for 13 October.
Afta we establish di key details, we dey able to identify common features for oda footage wey claim to show di incident.
Dis include one video wey dem shoot from about 100 metres away wey show di burning vehicles, but not di truck wey be like say na im use head carri most of di strike.
Before di attack
Another video bin start to dey circulate on X (formerly known as Twitter) early on Saturday morning.
E show one convoy wey dey run from northern Gaza, dem film am close to di location where dem record di aftermath of di strike.
We estimate say more than 30 pipo dey inside di vehicle wey dey di video. We know sabi if dis truck na di exact one wey dem hit for di footage wey we don see from di strike.
Online software wey dey analyse di angles of shadows tell us say dem likely film di video between 15:30 and 17:20 local time on Friday.
Di width and partition for di road show say e gatz be a major road, as di wide truck wey dey inside no go fit for residential street.
We use satellite imagery and we dey able to verify di vehicle exact location as we use di position of nearby buildings and trees, and analyse di shadows wey residential buildings show.
We also know say di attack take place south of dis location. Dem film dis video north-east of di attack, wey fit be where di convoy dey hours before dem hit am.


Concluding thoughts
Di Palestinian Health Ministry tok say 70 pipo die for di scene, and blame Israel for di attack.
Di IDF tok say dem dey investigate - but dem tok say dia enemies dey try prevent civilians from leaving di north.
BBC Verify go continue to monitor di situation and report any updates.

Additional reporting Rollo Collins











