You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria presidential elections results 2023: Bola Tinubu win Peter Obi, Atiku Abubakar
Di National Chairman of Nigeria Independent National Electoral Commission (Inec), Prof. Mahmood Yakubu don declare APC candidate Bola Tinubu as winner of di 2023 presidential election afta e receive results from di 36 states of di federation and di FCT.
Millions of Nigerians vote for di most competitive presidential election since military rule end.
Dem also vote to elect lawmakers into di national assembly. 109 federal senators and 360 members of di house of representatives, and dat for govnors dey hold in March.
Since 1999, Africa most populous kontri don dey dominated by two parties - di ruling APC and di PDP.
But dis time, e also get a strong challenge from one third-party candidate - di Labour Party Peter Obi, wey dey backed by many young pipo.
Di election see huge interest from first-time voters and young pipo - one third of di 87 million eligible voters dey below 35 - pipo bin tink say e fit lead to high voter turn-out dan di 35% wey dem record for 2019.
To win, one candidate bin need to get di most votes and 25% of ballots cast for two-thirds of Nigeria 36 states to be declared as di winner
If no-one achieve am, e for enta run-off wey for happun within 21 days - if e happun, e for be first for Nigeria history.
End of Di one wey oda users dey read well well