Ekiti governorship election results: Map wey show how Biodun Oyebanji win Ekiti state guber poll

Di candidates

Wia dis foto come from, Other

Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC don announce di kontri ruling party candidate, APC, winner of di Ekiti state govnorship election 2022.

Biodun Oyebanji poll 187,057 votes and win 15 out of 16 local goment areas for di state.

Im closest rival, SDP candidate Segun Oni poll 82, 211 votes while PDP Bisi Kolawole get 67,457 votes.

Di election happun on Saturday 18, June 2022 and Inec declare di winner around 3:00am on Sunday, 19 June.

According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast.

Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election).

Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions.

Move around di map to see di breakdown of how Oyebanji win di election