Una bye-bye!
Na for here we go march break ontop our live coverage of di 2022 Ekiti govnorship election.
We thank una for staying with us.
Una good morning!
Residents of Ekiti state vote for who go govern dem for di next four years.
Helen Oyibo and Victor Ezeama
Na for here we go march break ontop our live coverage of di 2022 Ekiti govnorship election.
We thank una for staying with us.
Una good morning!
Inec don declare APC candidate Biodun Oyebanji di winner of di Ekiti govnorship eelction for 2022.
Oyebanji score 187,057 votes to win.

Inec returning officer don read out di numbers from di Ekiti election.
See dem according to Professor Kayode Adebowale.
Total number of registered voters - 989224
Total number of accredited voters - 363468
APC - 187,057
PDP - 67,457
SDP - 82,211

APC candidate Biodun Oyebanji win a total of 15 out of 16 local goments wey Inec call for di Ekiti state govnorship election.
Although PDP win one local gomet area, SDP follow APC for back with number of votes from wetin Inec call.
Inec go still call out di total number of votes for each party before dem finally declare di winner.

For Ekiti East, APC win with 12099 votes.
APC don win di last local goment wey Inec call for di Ekiti state govnorship poll, Ekiti East.

For Gboyin local goment area, APC lead with 11247, SDP follow with 4059 votes.
APC don win Gboyin local goment area.
Inec don call 14 local goments so far.
Out of di 14, APC don win 13 while PDP don win only one.
Di two remaining local goment areas na Ekiti East and Gboyin.
For Ikole, APC lead again wit 16417, PDP follow with 6266 while SDP come afta with 5736 votes.

APC win Ikole local goment area with 16417.

For Ado Ekiti local goment. APC lead with 23831, SDP follow with 15214.
APC win Ado Ekiti with wide margin of 23831 votes.
APC again lead for Ise Orun local goment area wit 8074, SDP come second with 5909 while PDP follow with 2588.

APC don win di Ise Orun local goment area.
For Oye, APC lead with 13396 votes while SDP follow for back with 5391 votes.

APC don win Oye local goment area.

For Ido Osi, APC lead with 10321 votes.
APC win Ido/Osi local goment area wit 10321 votes.