Alaafin of Oyo death: Oba Lamidi Adeyemi of Oyo state don die

Read am in 3 mins

Nigerians dey react to tori say one prominent Yoruba king, di Alaafin of Oyo, Oba Lamidi Adeyemi, don die.

Local tori pipo dey report say Alaafin Adeyemi, di third from di Alowodu Ruling House, die in di late hours of Friday.

E be 83 years old and na di longest reigning Alaafin ever afta e rule for 52 years.

Di Media and Publicity Director of Alaafin, Bode Durojaiye confam di tori to journalists say di king don die.

Local tori pipo dey report say e die in di late hours of Friday for di Afe Babalola University Teaching Hospital, Ado Ekiti, di capital of Ekiti State for South-West Nigeria.

Since di tori begin circulate, pipo don dey react, wit many dey send condolence why some point out di death of oda strong Oyo kings dis year too.

Oyo state Govnor Seyi Makinde never tok about am.

Death of Oyo kings

Di death of di Alaafin dey come just some months afa di death of di Olubadan of Ibadan land, Oba Saliu Adetunji Ajeoguguniso I

Na for private hospital for Ibadan, Oyo state, dem comfam im passing on Sunday morning, January 2, 2022.

Im bin dey 93-years-old.

Anoda death wey also rock Oyo recently na dat of di Soun of Ogbomoso, a first class king for Ogbomoso land.

Oba Jimoh Oladunni Oyewumi die at di age of 95 on Sunday, 12 December, 2021.

Oba Oladunni Oyewumii before im death b e di di 20th Soun of Ogbomoso and im become king for 1973.

Who be Alaafin of Oyo

Dem born Alaafin Adeyemi III as Lamidi Olayiwola Atanda Adeyemi on October 15, 1938 into di Alowolodu Royal House, and as member of di House of Oranmiyan to Raji Adeniran Adeyemi (born 1871), who later become Alaafin for 1945, and Ibironke of Epo-Gingin, wey die wen e still dey young.

Im paternal grandfather na Alaafin Adeyemi I Alowolodu, e rule during di Kiriji War, and na di last independent ruler of di Oyo Empire before British colonialism.

Alaafin Adeyemi I papa, and Adeyemi III great-grandfather na Oba Atiba Atobatele, wey found New Oyo.

Atiba papa, im great-great grandfather, na Alaafin Abiodun, and e be direct descendant of Oranmiyan, di founder of di Oyo Empire.

Dem depose Lamidi papa, di Alaafin of Oyo Oba Adeyemi II Adeniran and exile am for 1954 say e sympathize wit di National Council of Nigerian Citizens (NCNC). E get gbege with Bode Thomas, deputy leader of di Action Group.

Lamidi Adeyemi succeed Alaafin Gbadegesin Ladigbolu II for 1970, during di governorship of Colonel Robert Adeyinka Adebayo, afta di end of di Nigerian Civil War. For 1975, di head of state General Murtala Ramat Muhammed include Oba Adeyemi for im entourage to di hajj. E be chancellor of Uthman dan Fodiyo University for Sokoto from 1980 to 1992.

For 1990, President Ibrahim Babangida appoint am as Amir-ul-Hajj in recognition of im commitment to di consolidation of Islam for Nigeria.

E bin dey married to Ayaba Abibat Adeyemi, im senior wife. E dey attend most events with her or with one of di oda junior wives wey e also marry.